Connect with us

As e dey Go

Victor Osimhen refuse to play penarity for Napoli after TikTok admin use am do yeye

Published

on

Victor Osimhen apologise to Napoli coachie

My people e be like say Naija striker, Victor Osimhen don comot body from penarity matter for Napoli. Dis na because when Napoli win penarity kick for dem first goal during dem match with Udinese last night, when everybody dey expect Osimhen to carry tha ball play the thing as Napoli penarity taker, the 24 years old striker no even near there.

Na diswan make him Napoli teammate, Piotr ZielinskI carry the ball, convert the penarity to make am 1-0 for Napoli. Na Victor Osimhen score the second goal as the Serie A defending champions finally win the match 4-1.

Una remember say gbege burst during Napoli last match when dem draw 0-0 with Bologna. As the club dey hustle for goals during that match naim ref nak dem penarity. As dem penarity taker wey him be, Victor Osimhen step up only to play the ball off target.

Maybe Na diswan make coachie, Rudi Garcia substitute the Super Eagles striker from the match wey make Osimhen provoke hala for the coachie. Although the boy later apologise to the coachie and him teammates, da wan no stop Napoli TikTok people from using one short video take yab the boy.

FIFA nominate Victor Osimhen for the 2023 Best Player Award

Inside the video, dem show Osimhen dey beg for penarity and when dem give am the penarity, him troway am. The video contain all dis baby-baby voice wey dey pain well well if na you dem dey use am against. The TikTok video provoke many Naija people wey make dem vex go pressurize Napoli until dem delete the video.

The thing pain Victor Osimhen well well too wey make him agents release statement say dem ready to sue Napoli for dat kind nonsense behaviour. Although the bobo show professionalism to still turn up for dem match last night despite the provocation, him refuse to shake hands with some of him teammates. And now, the boy don comot body for anything penarity for Napoli.

 

As e dey Go

Forget about the 3-0 flogging, Manchester United play very well – Erik ten Hag

Published

on

Erik ten Hag don tell Manchester United players say you either shape up or shape out

After collecting dat humiliating 3-0 flogging inside Old Trafford, Manchester United coachie, oga Erik ten Hag don come outside dey announce to the world say him boys play very well regardless of wetin the score line talk.

Ten Hag defensive formation look like e get comma because na both Harry Maguire and Johnny Evans start while Raphael Varane dey bench. Also the coachie start Victor Lindelof for left back when Regulion wey be natural left back dey bench.

VAR award City penarity after Rasmus Hojlund drag Rodri down inside 18 yard box. Erling Haaland use dat penarity take rediscover him Premier League scoring form to make am 1-0. Andre Onana make many excellent saves for dat match but him no fit deny Haaland second goal with one powerful header to make am 2-0.

Forget about the 3-0 flogging, my boys play very well - Erik ten Hag

Erling Haaland destroy Erik ten Hag boys

The third goal come after Onana make another excellent save to deny Rodri, only for the ball to come meet Haaland wey square the ball back for Phil Fodden to complete am 3-0. But Erik ten Hag don come outside dey defend him boys performance say dem play well. According to am:

If you watch the first half you go see am say nothing City take pass us. We jam dem head to head, if no be dat penarity maybe e for be first half draw. Even with the penarity sef, we too create chances wey we just no convert. See dat McTominay own, on a good day goal be dat ball. So yesterday na just bad day for market for us.

Manchester United don lose five out of 10 league matches so far dis season. Out of those five losses, three na for Old Trafford. And as e be now, dem dey 8th position on top table, eight points behind the Top 4 and 11 points behind Tottenham wey dey top league.

Continue Reading

As e dey Go

American footballer threaten to stab referee for street because of red card

Published

on

As e dey hot, we don dey hear say one footballer inside American League, Yohance Alexander don threaten to stab referee if him catch am for street. The reason for dis kind vawulence na because the ref nak Alexander red card during dem cup match wey shele inside New York.

Na during the 2024 US Open Cup Qualifying game between Alexander club, NY Renegades vs NY Pancyprians-Freedoms naim dis matter happen. According to the tory, NY Renegades dey collect 3-0 kponking when dem vex turn football to karate begin kick opponents leg instead of ball.

E no tay naim quarrel start and to settle the quarrel, ref begin distribute yellow card to the players of both teams wey involve for the fight. But somehow, Yohance Alexander no grading wetin dey happen na so e begin go dey argue with ref o.

Na dat argument make ref vex nak am red card but instead of to respect himself leave the pitch, Alexander continue to dey insult the ref until e vex tell the ref make e pray make him no catch am for street because if e catch am there, e go stab am anyhow.

American footballer threaten to stab referee for street because of red card

Some players just like to dey fight referee especially when dem collect red card

Na dat threaten make the referee provoke end the match after only 74 minutes and right now we dey hear say dem also don disqualify NY Renegades from the tournament because of the bad talk wey Yohance Alexander talk.

We also dey hear say Alexander fit collect one long ban from the league for dat threaten wey him threaten referee. On top of dat, both him and him club go chop huge fine so dat tomorrow if dem see referee, dem go respect am well well.

 

Continue Reading

As e dey Go

Sadio Mane don buy football club inside France

Published

on

Sadio Mane don buy professional football club inside France

We don dey hear now say Senegal striker, Sadio Mane don buy one football club inside France wey dem dey call Bourges Foot 18. The club dey play for the fourth division of French League.

According to the tory, e don tay wey Sadio Mane don dey find club wey him go buy but e no work out until now. And the former Liverpool winger no be stranger for Bourges Foot as him don dey donate money give the club right from time to help dem pay salary and buy players for more than 3 years.

Na all dis good-good things wey him dey do make am become paddy with the owner of the club as well as the mayor of the town wey the club locate. And as e be now, the club president don kuku advise am to close eyes buy the club so dat him go begin control the club fully.

Sadio Mane don buy football club inside France

Mane currently dey play for Al-Nassr inside Saudi

Bourges Foot 18 currently dey second to the last for Group B of French fourth division. But the club been dey perform better pass like dis, in fact the club don play for Ligue 2 before wey be the second division of French league. But since then things no go well with dem wey don push dem enter Division 4 so.

But as e be now, the club president and Mayor of the town believe say the way forward na to sell the club give Sadio Mane. And Mane sef wey start him football career for France, don tell dem say him plan na to reorganize the club and return am back to dem former glory.

Continue Reading

Trending