As e dey Go

Victor Osimhen refuse to play penarity for Napoli after TikTok admin use am do yeye

Published

on

My people e be like say Naija striker, Victor Osimhen don comot body from penarity matter for Napoli. Dis na because when Napoli win penarity kick for dem first goal during dem match with Udinese last night, when everybody dey expect Osimhen to carry tha ball play the thing as Napoli penarity taker, the 24 years old striker no even near there.

Na diswan make him Napoli teammate, Piotr ZielinskI carry the ball, convert the penarity to make am 1-0 for Napoli. Na Victor Osimhen score the second goal as the Serie A defending champions finally win the match 4-1.

Una remember say gbege burst during Napoli last match when dem draw 0-0 with Bologna. As the club dey hustle for goals during that match naim ref nak dem penarity. As dem penarity taker wey him be, Victor Osimhen step up only to play the ball off target.

Maybe Na diswan make coachie, Rudi Garcia substitute the Super Eagles striker from the match wey make Osimhen provoke hala for the coachie. Although the boy later apologise to the coachie and him teammates, da wan no stop Napoli TikTok people from using one short video take yab the boy.

Inside the video, dem show Osimhen dey beg for penarity and when dem give am the penarity, him troway am. The video contain all dis baby-baby voice wey dey pain well well if na you dem dey use am against. The TikTok video provoke many Naija people wey make dem vex go pressurize Napoli until dem delete the video.

The thing pain Victor Osimhen well well too wey make him agents release statement say dem ready to sue Napoli for dat kind nonsense behaviour. Although the bobo show professionalism to still turn up for dem match last night despite the provocation, him refuse to shake hands with some of him teammates. And now, the boy don comot body for anything penarity for Napoli.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version