As e dey Go

Pesin shoot Italian Mafia pikin die during Napoli Serie A celebration

Published

on

No be small sontin shele inside the city of Naples for Italy as we don dey hear now say somebody don shoot the son of one Italian Mafia boss as dem dey celebrate Napoli Serie A title win. And before dem fit rush the boy reach hospital, the boy don die saara.

Naija boy, Victor Osimhen score late goal wey Napoli take draw 1-1 away for Udinese and clinch their first Scudetto in 33 years. With 16 points gap and 5 games to go, e don dey mathematically impossible for anybody to overtake dem.

After that match naim Napoli fans pack demsef enter pitch to celebrate with dem players only for Udinese ultras to meet dem there begin fight dem. Those Udinese fans use belt and every other kind weapons take beat Napoli fans sotay about 8 of dem land inside hospital.

Victor Osimhen score the goal wey give Napoli the league

While many people dey hope say the gbege go end there, the worst go later happen because as people come out from their houses enter street to celebrate with dancing and drinking and carnival, before we know gunshot don begin sound everywhere and people begin run for dem life.

After the dust settle, more than 100 critically injured people don collect bed for ICU inside hospital while Vincenzo Costanzo, the son of the Oluomo of Napoli, Maurizio Costanzo don chop bullet wey end him life.

Vincenzo Costanzo na the son of the Oluomo of Napoli wey dem dey call Maurizio Constanzo. At 26 years old dis bobo don already bad like him papa sotay the file of him criminal record for police station full Ghana must go.

The worst part be say e get one cult war wey dey shele currently for their zone so different rival cults just dey hit themself anyhow. So we no come know whether na rival gang body the guy so abi na the many many people wey him don offend finally locate am serve am cold dish of revenge.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version