Wetin shele gan-gan

FIFA dey investigate Zambia coachie for rubbing him female players chest again

Published

on

We don dey hear now say FIFA don finally dey investigate the coachie of Zambia Women’s football team, oga Bruce Mwape for sexually harassing him own female players wey him suppose to take care of. FIFA finally decide to investigate the matter after dem accuse the coachie of doing it again during the World Cup.

Na before the World Cup naim dem don first report to FIFA say dis 63 years old man na dirty old man wey dey always like to play with the girls body, dey touch dem breast and even dey slap dem yansh. This na small small girls wey dey young enough to be the coachie granddaughters.

But oga Bruce Mwape deny the allegations say all those things wey dem dey talk say him do, all na fake news and at no time him touch anybody bobbi or backyard. But now, FIFA don receive another report say the Zambia coachie don do am again.

Zambia Women finally win one match for Women’s World Cup

Them say dis time na after dem last training wey shele last Friday before dem last World Cup match wey dem beat Costa Rica 3-1, naim diswan happen. Them say na immediately after that training naim the coachie go dey massage one babe all over her chest. And since diswan shele inside World Cup, them don report to FIFA.

FIFA sef don kuku confirm say dem don receive the complain of sexual harassment and say dem don begin investigate the matter so therefore make everybody calm down until FIFA complete dem investigation before dem go know the way forward.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version