As e dey Go

Transfer news: Chelsea want Harry Maguire, Manchester United don sign Casemiro

Published

on

For transfer news dis morning, we don dey hear now say Chelsea don point dem hand straight to Harry Maguire say dat Manchester United skippo wey everybody dey treat like leper, na dat guy naim dem need to complete dem defensive formation.

Na Manchester United start everything after dem go dey price Chelsea winger, Christian Pulisic say dem need the bobo to come push attack for dem. But now Chelsea don reply dem say, if una want Pulisic, no wahala. But in exchange, una go give us Harry Maguire make we use am take balance the equation.

Harry Maguire wey be United skippo don dey under heavy probation since last season and many United fans go even dey pray make him go. But e go hard to sell Maguire now because wetin make 2 UCL clubs, Barcelona and now Chelsea don try to sign am dis transfer window, da means be like the bobo still get something to offer.

Manchester United don sign Casemiro

Manchester United don complete the signing of Casemiro from Real Madrid on top total package of 70 million pounds. We hear say the contract go last for 4 years and Casemiro salary go make am one of the highest-paid players for United and possibly for the whole EPL.

Manchester United don sign Casemiro from Real Madrid

Casemiro na 30 years old solid defensive midfielder wey don win 5 UCL title with Real Madrid. Unlike other United signings, dis Casemiro own happen quickly and with the kind midfield problems wey United dey get now, Casemiro experience and winning mentality suppose for help dem out for dat department.

Eric Bailly to join Marseille on loan

We don dey hear now say Manchester United Ivory Coast defender, Eric Bailly don dey warm up to join Olympique Marseille on top loan contract for the season. We hear say dis loan contract go also include option to buy.

Eric Bailly finally no find him bearing for Manchester United and now dem wan carry am go France on loan

Eric Bailly a one defender wey many people believe say him solid well well and dem need to give am chance to prove himself for Manchester United. Unfortunately, anytime wey dem give am opportunity him must commit one calamity or the other. Na diswan make dem wan move the guy on make e find club wey go favour am.

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version