As e dey Hot

Manchester United fans dey protest against dem new green jersey say e look like ewedu

Published

on

Manchester United never release dem new jersey but dat new jersey wey dem never release don already dey cause problem because after the thing mistakenly go leak online, Manchester United fans don use anger and provocation take enter social media say which kind yeye jersey be diswan?

According to the fans, the jersey look like vomit wey small pikin wey jus begin learn how to chop solid food vomit. Some other fans say the thing resemble ewedu soup wey dem no use broom take turn am well on top fire wey make the ewedu lose colour.

Some other fans say the jersey na original bad luck jersey because of the colour. According to them, upon say na red them dey wear when Brighton beat dem 2-1, yet the United players no dey see each other well to pass ball give each other. So imagine say dem come wear green wey get the same colour with grass. Da means dem go kukuma dey invisible for each other eyes.

E be like say Manchester United dey plan dis jersey thing because na so last season dem use dis zebra jersey take torment dem fans

When we use clear eyes take torchlight dis jersey wey leak so, we see am say the thing no too bad like that o, especially if you be Nigerian wey dey support Super Eagles and Super Falcons. The jersey colour na almost the same thing with that Naija light green jersey.

But where this United own take begin get k-leg na the other greenish stripe wey come dey all over the tin wey come make am look like green zebra. Upon that, the badge and the logo look like wetin one printer for Aba run for dem. Na diswan don make fans dey provoke say, ball dem no sabi play, fine jersey, dem no sabi do. Which kind wahala be dis?

This no be the first time wey United dey nak us jersey wey make us dey wonder weda na Adidas really dey design dem jersey abi na Abidas of Ogbomosho. Last season na zebra jersey dem nak us wey make us begin wonder weda na prisoners naim design am with free labour.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version