Wetin shele gan-gan

Cristiano Ronaldo don finally find buyer and him don ask Manchester United to name dem price

Published

on

We don dey hear now say Manchester United big egunu, Cristiano Ronaldo wey dey waka upandan since dey find buyer, e be like the bobo don finally find club wey wan sign am and na wetin him fly all the way from Portugal to come tell dem for Manchester be dat.

Una remember say Cristiano Ronaldo wey still get 1 year for him contract don ask United to sell am if any club come to buy am. Dis na because him wan play for champions league next season and him no wan follow United go Europa League.

Since then both Ronaldo and him agent, oga Jorge Mendes don dey waka upandan dey kiri dem market go different clubs. Dem first carry am go Chelsea wey dem new owner, oga Todd Boehly really like wetin him see but unfortunately, Chelsea coachie, oga Thomas Tuchel say him no need player like am.

Atletico Madrid fans continue to dey protest against Cristiano Ronaldo even with dis big banner during preseason friendly

From Chelsea dem turn face go PSG but PSG no even wait make dem land before dem reject am. Next stop na Bayern Munich but dem oga kpatakpata, Oliver Kahn clear dem say dem no fit sign Ronaldo because him no fit dem club philosophy.

But the biggest disappointment come from Atletico Madrid wey dem carry Ronaldo go even dey plan collect salary cut but Atletico fans begin do EndSARS protest on top Ronaldo head say if the club mistakenly sign Ronaldo, dem go disown the club go dey support Nasarawa United instead.

So when Ronaldo finally return to Manchester United dis week after missing dem preseason, many people think say na the story of prodigal son wey don finally come back. But we don dey hear now say Ronaldo only return to tell United oga dem say him don finally find buyer.

According to Ronaldo, dis buyer na United rivals and dem wan know how much United wan sell before dem come public. Therefore, Ronaldo want make United tell am how much dem want as transfer fee so dat the club go come pay the money make dis transfer saga end once and for all. United no gree sha because dem want make Ronaldo remain for the club.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version