As e dey Hot

“Manchester United claim say dem love me but na lie!”-Paul Pogba on why him leave United

Published

on

Former Manchester United midfielder, Paul Pogba don come outside with provocation dey point hand inside the eyes of the club oga dem say walai talai the way dem take handle him contract situation for the club show say dem no rate am at all. Pogba say na so so lip service dem take dey claim say dem love am but when time reach to prove am by improving the salary inside the new contract wey dem dey give am, dem begin drag leg like man wey no get money go mistakenly enter Cubana.

Pogba make dis accusation for the new episode of the documentary wey Amazon dey run for him career as a footballer. Paul Pogba don finally leave Manchester City after several years of playing boju-boju wey him agent then, the late oga Mino Raiola go talk today say him wan comot from United. Tomorrow United go say him no dey go anywhere. Next tomorrow him brother go say him dey comot. Another day Pogba himsef go say him still gallant for United. Sotay even Pogba barber sef don chook mouth for the transfer matter.

Paul Pogba inside the documentary

And now wey him don finally leave the club dey ready to join Juventus, the bobo don come outside dey cast Manchester United with him full chest say dem no treat am like a player wey dem rate all. According to Paul Pogba:

”Me I just wan use this opportunity take show United say no be everytime dem go dey do anyhow and get away with am. Dem dey talk say dem want me to stay but to show me new contract na problem. Even when dem finally show me the contract, I go see am say nothing new dey inside. No assurance, no better money on top, the thing jus be like when you get girlfriend, you believe say the girlfriend love you so therefore no matter wetin you do, she go still take am like dat.”

But Pogba say it can never be him o. As far as he is concerned, na the same thing wey African Chyna sing naim him go tell United, so if you love somebody, show the pesin say you love am and you want am to stay. Him say United insist say dem want am to stay but dem no fit back am up with better money. And right now him mission na to show United say dem make big mistake.

Paul Pogba join United from Juventus for 2016 on top transfer fee of £89 million wey make am the most expensive player then. But Pogba form for United be like Nepa light as the thing just dey of and on and turnioniown. Na wetin make am no really play the kind ball wey fans expect am to play. And na wetin make am don leave United on top free transfer for the second time for him career be dat.

2 Comments

  1. Afoke Jonathan

    June 16, 2022 at 8:52 pm

    Pogba no knw himself na real NEPA him b for united

    • Ejike Kanife

      June 16, 2022 at 8:59 pm

      Hahahaha. You go fear Nepa light na. E dey tomorrow, tomorrow you nor go see am again

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version