As e dey Hot

Erik ten Hag don warn Manchester United players say you either shape up or shape out

Published

on

New Manchester United coachie, oga Erik ten Hag don dey draw ear give Manchester United players dey warn dem say; This my government no be government of ishekushe o. Me I no dey look Uche face and anybody wey do anyhow go see anyhow because I no get time for nonsense.

We hear say Ten Hag send this message to the email of every Manchester United senior team player. Last season na disaster for United. Even though dem manage to finish 6th on top EPL table, na so so igbakugba dem play. On top of that we still hear say the players dey always fight demsef on top pitch sotay dem even cancel training after one streetfight wey shele.

Last season na disaster for Manchester United with plenty igbakugba for pitch and streetfight for training

Na wetin make the new coachie don dey shake head say, mbanunu, my team no fit worwor like this. Oga ten Hag tell players say from today nothing like big player because everybody go dey the same level. Him also remind them say football na team game and every player must hustle for jersey for training otherwise, na OYO be dem name.

According to oga Ten Hag: “The kind drilling wey I go drill una ehn, even army people wey dey go fight Boko Haram never chop that kind drilling. But in the end na you go enjoy am because you sef go see am say your fitness don improve under my government pass any other time of your life. I go train you hard until you master my plan. But if you no fit master am, whether your name na Ronaldo or Maguire, I go nak you for bench find younger player wey ready to do my work.”

Ten Hag also warn anybody wey no support him government go carry all him kaya inside kowope and discharge from the club.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version