As e dey Hot

David Alaba say Rangnick na world class coach, na Manchester United no give am time

Published

on

Real Madrid and Austria superstar defender, David Alaba don come outside dey shalaye say this Ralf Rangnick wey people just dey bad mouth anyhow, the guy na correct coachie wey sabi work well well. Alaba say Rangnick for shine for Manchester United if to say dem make am full landlord for the club instead of the caretaker work wey dem carry give am.

Una remember say United carry Rangnick come England all the way from Germany to come become dem new conductor driver after dem sack dem former coachie, oga Ole Gunnar Solksjaer for November 2021. When dem employ am, everybody dey hail am say na him be oga wey be master wey other ogbonge coachie dem like Klopp and Tuchel do boy-boy for him hand, therefore, him suppose do the conductor driver work well.

But instead of to drive the danfo reach bus stop, oga Rangnick drive am enter BRT lane sotay by the time the guy caretaker work finish for United, him don become the worst Manchester United coachie for EPL history with the lowest win percentage  (37.9%) after only 10 wins inside 24 matches.

But Alaba don come outside dey praise Rangnick like delegates dey praise Buhari for APC Primaries say make nobody stress Rangnick because bad as him record be for United, na because dem no give am time to work.

“Na this same Rangnick show all working for Leipzig, for Salzburg and even for Hoffenheim and everybody see am say him sabi work. Therefore if e no work out for United, that means there’s problem somewhere and the way I see am, na because dem no give am enough time to show him talent. But e good like data sef because right now we dey enjoy the guy for Austria. The guy game plan always dey on point and the plan is simply make we choke the opponents until dem begin ask who dey breet? Then we go finish dem off. I don know Rangnick since I dey 18 years old and I fit tell you say the man na world-class coachie.

See also: England fans wey carry mkpurummiri enter Qatar World Cup fit chop death penalty

For him first match as Austria coachie, oga Ralf Rangnick carry dem beat Croatia 3-0 away win for dem UEFA Nations League match. But him chop him first L for him second match when Denmark nak Austria 1-0 for dem own backyard. But e be like Austria players get serious confidence for Rangnick and we pray say the bobo succeed there at least to remove small shame of Manchester from him face.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version