As e dey Hot

England fans wey carry mkpurummiri enter Qatar World Cup fit chop death penalty

Published

on

England fans wey dey ginger them country (Credit: Daily Mail)

As England dey prepare to go Qatar go hustle them first World Cup since 1966, authorities for Qatar don dey draw ear give England fans wey go come support them country say Qatar no be country wey dey play with anybody o. If dem mistakenly smuggle cocaine or mkpurummiri enter Qatar and police catch dem, see dem see firing squad.

According to Qatar 1987 Law 9 on top Control and Regulation of mkpurummiri matter, anybody wey smuggle cocaine enter the country and them catch am, that person go face 20 years inside Kirikiri on top fine of between 21,000 to 64,000 pounds. When Aboki convert that money for us, we see am say na between 11 million to 34 million naira we dey talk about so.

But if village people follow the person e come be say na the second time wey dem dey catch am with hard drugs, e no matter whether na for Qatar them catch am the first time or whether na for Seme Border, as long as say them don catch somewhere before with mkpurummiri, that one na straight to firing squad or life imprisonment.

England fans and hard drugs be like ewa agoyin and Agege bread sotay even inside stadium when match dey shele, some hoodlum dey waka upandan dey sell mkpurummiri give fans. But na after Euro 2020 naim breeze blow wey fowl nyash open wey make people realise say na hard drugs dey give those fans morale no be ordinary beer.

The matter tie wrapper sotay England authorities don dey warn dem fans wey dey plan enter Qatar for World Cup say: if dem catch you with cocaine or any other hard drugs for Qatar, my brother and my sister, na OYO be your surname o. No call us for the matter because we no go answer you. No be we send you to carry mkpurummiri enter another man country. In short, any fan wey misbehave for Qatar World Cup, anything wey dem do you there if you return back home we self go nak you more punishment join. Because pikin wey say him mama no go rest, that pikin go see that problem wey him dey find.

Although na England fans naim Qatar authorities dey give this special warning, the punishment go also affect fans of other countries wey wan try themself. Qatar no get “sorry” for them dictionary and if dem mistakenly catch you with hard drugs, you go understand the real meaning of wotorwotor.

3 Comments

  1. Pingback: Alaba say Rangnick na world class coach but Man United no give am time

  2. Pingback: Babalawos inside Peru do crusade to help Peru qualify for World Cup

  3. Pingback: Qatar don ban gbenshing and public kissing for 2022 World Cup

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version