Meet the players

Transfer news: Cristiano Ronaldo wan collect paycut to jakpa from United, Origi don join AC Milan

Published

on

For transfer news dis morning, we don dey hear now say Manchester United attacker, Cristiano Ronaldo don ready to accept hooge pay cut just to fit jakpa from Manchester to any other club wey go sha play for champions league next season.

Ronaldo wey many people consider as the GOAT of football dey collect salary of around 500,000 pounds every week wey make am the highest salary earners for EPL. But as e be now, the bobo don ready to humble him salary just to fit play elsewhere because true true no be every club go fit afford to pay da kind money at all in the first place, talk more of to player wey don dey approach 40.

Na Cristiano Ronaldo be Manchester United top scorer last season with 18 EPL goals. Unfortunately na only 6th position and Europa naim those goals help dem reach and now, Ronaldo wey believe say him don big pass to dey play Europa and say Messi fit overtake and for UCL all-time top scorer if him no play, wan port go any UCL club. Some of the clubs wey fit reason him matter na Chelsea, Bayern Munich and PSG.

Liverpool hero, Origi don finally leave the club

Divock Origi don finally prove say dem no bury him placenta for Liverpool by joining AC Milan

Liverpool cult hero, Divock Origi don finally pack all him bags and baggages waka leave the club after 8 solid years for the club. Although Origi no be regular player for those 8 years, the guy give Liverpool so many many unforgettable moments especially with the kind of goals wey him score for dem.

Shay make we talk about the two goals wey him score against Barcelona as Liverpool register one of the biggest comebacks for UCL history from 3-0 down to win 4-3. Liverpool fans no go forget dat wucked set up wey him and Alex-Arnold serve Barca. Abi na dat late winning goal for Merseyside derby against Everton wey turn Klopp to mad man. Memories plenty but unfortunately, all good things must come to an end and now, 27 years old Origi don go start the new chapter of him life for AC Milan after scoring 41 goals for 175 matches for Liverpool.

Juventus don agree to sign Paul Pogba

We don dey hear now say Juventus don finally agree to sign Paul Pogba on top free transfer with 4 years contract. Una remember say Pogba become free agent after him allow him contract to expire with Manchester United without renewal. And e no end there as the bobo later enter media go yan say the reason when him no accept United contract renewal na because him jus wan show dem pepper.

Pogba don finally agree to join Juventus after rejecting Man United new contract just to show dem pepper

Pogba join United from Juventus on top world record transfer fee of 89 million pounds. But the bobo no show the kind action wey make dem buy am from Juve but even then the club ready to keep am anyhow sotay dem even offer am new contracts but the guy no gree sign until him time expire. As e be now, the bobo go return to Juventus for free with the mind of kickstarting him career.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version