As e dey Go

Serge Gnabry say him no fit play for any London club except Arsenal so make Chelsea forget about am

Published

on

We don dey hear now say Germany and Bayern Munich winger, Serge Gnabry don come outside dey shalaye say him no fit play for any other club inside London because of him love for Arsenal.

Diswan dey shele as Chelsea don begin chook eyes for the former Gunners matter after Raphinha wey be dem first choice fall dem hand decide to play for Barcelona instead. Una remember say Chelsea been wan hijack Raphinha transfer from Arsenal before Barcelona kuku show dem who be the real sugar daddy by hijacking the transfer.

Serge Gnabry join Arsenal for 2011 when him dey just 16 years old. Although e get when injury force Arsenal coachie then, Arsene Wenger to begin play am, e still no stop the fact say the coachie no too believe in the guy wey make am loan am to West Brom. At the time West Brom coachie, oga Tony Pulis even say Gnabry level no reach to play for West Brom.

Serge Gnabry score 1 goal and win 2 FA Cups for Arsenal

But that one no stop Serge Gnabry from returning to Arsenal where him play 18 matches, score 1 goal and win 2 FA Cups with The Gunners. Na diswan make Gnabry love Arsenal sotay sometimes him dey wear Arsenal jersey take dey do light exercise for house. Another time, the boy confess say once a Gunner, always a Gunner.

And now, according to German media, Serge Gnabry wey don win 4 Bundesliga, UCL and Club World Cup with Bayern Munich, don shalaye say him no fit play for any other club inside London because of Arsenal. But if na Manchester City, Liverpool or United, him fit play, but certainly not Chelsea or Tottenham or any other London club.

Serge Gnabry contract with Bayern Munich remain only 1 year. And though the club don offer am new contract of 200,000 pounds per week, the bobo no gree accept am. Na diswan don make everybody alert say the guy available wey make Chelsea don dey chook eyes so. Manchester City sef fit chook eyes there as dem don sell Raheem Sterling so and Bayern Munich no go sell the bobo for anything less than 45 million pounds.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version