As e dey Go

Transfer news: Chelsea wan dash Barcelona Azpilucueta, Alonso and £51m for De Jong, Juve don sign Di Maria

Published

on

For transfer news dis morning, we don dey hear now say Chelsea don ready to chance Manchester United for the race to sign Frenkie de Jong as dem don ready to dash out dem captain, Cesar Azpilicueta as well as Marcos Alonso plus 51 million pounds to Barcelona just to collect the 22 years old Dutch player come Chelsea.

Una remember say Manchester United don dey pursue dis bobo since because dem new coachie, oga Erik Ten Hag don declare say na dat boy go be the most important market wey United must buy. United sef don ready to pay transfer fee of 65 million euros wey fit rise to 80 million if the bobo perform well.

One of the main reasons why Frenkie de Jong never leave Barca na because we hear say the club dey owe am money like government worker. But diswan wey Chelsea wan hijack the whole thing so, we no con know wetin dem plan to do about the salary.

Juventus don sign Angel Di Maria for free

Juventus don complete the signing of former Real Madrid and Manchester United winger, Angel Di Maria on top free transfer from PSG. Immediately the bobo land Turin naim him ask the club to nak am him favourite Number 22 jersey and dem comply immediately.

Juventus don carry Di Maria on top free transfer, nak am him favourite Number 22 jersey

Di Maria na very experienced 34 years old winger wey don win trophies all over Europe. From Real Madrid to United and even PSG, na so trophies just dey follow the bobo everywhere. And with the kind squad wey Juve dey razzle under Massimiliano Allegri, walai talai sumobinlai, I fear who no fear Juventus.

Tottenham don sign Lengelet on loan

For the last transfer news today, Tottenham don continue with dem mission to improve dem squad with very experienced players as dem don finally complete the signing of Clement Lenglet from Barcelona on top 1 year loan contract. The loan contract no get option to buy sha.

Lenglet don join Tottenham on loan to help the team with him UCL experience

Lenglet become the fifth player to join Tottenham dis transfer market after dem sign Fraser Forster wey be keeper, Ivan Perisić wey be winger, Yves Bissouma wey be central midfielder, and Richarlison wey be forward. Lenglet na 27 years old central defender wey don win La Liga, Copa del Rey and Spanish Super Cup for Barcelona.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version