Wetin shele gan-gan

How Barcelona take dey owe Frenkie De Jong salary of €23.5m and how e dey affect him Manchester United transfer

Published

on

We don dey hear now say Barcelona don dey behave like some Nigerian state governments wey dey owe workers salary because the salary wey dem dey owe Frenkie de Jong na around 23.5 million euros. When we meet aboki to change dis money for us, we see am say na around 10 billion Naira we dey talk about so.

Dis money na mostly from the paycut wey De Jong collect during the COVID-19 pandemic wey many clubs lose money around the world. According to the agreement of the De Jong pay cut wey dem sign for 2020, any money wey dem minus from him salary of 14 million euros per year, dem must pay am back later. With dat agreement him also sign 2 years extension wey for keep am for the club till 2025.

How Barcelona take dey owe dis boy all dis money?

For 2020/21 season, instead of 14 million euros wey be him salary, dem pay De Jong only 3 million con dey owe am 11 million. For 2021/22 season dem pay am 9 million remaining 5 million. This 5 million plus the 11 million wey dem dey owe am before making it 16 million euros.

Now e get one bonus of 2 million euros wey dem promise am if him play up to 60% of dem matches any season of which him achieve am for those last 2 seasons meaning say him get extra 4 million. Plus dat 16 million salary shebi na 20 million be dat?

Then dem get 3.2 million euros bonus if him win any cup or at least reach UCL final for Barca. After winning Copa del Rey of 2020/21, him don activate dat 3.2 million euros be dat. If you add am to the 20 million, that is 23.2 million euros naim Barcelona dey owe Frenkie De Jong so.

New Manchester United coachie, Oga Erik Ten Hag dog like continue him collabo with De Jong from Ajax

E even be like say e follow for wetin make Manchester United never still fit sign Frenkie De Jong since 19kokoro because if Barcelona no pay am all him money, him no dey go anywhere. Even though Barcelona presido, oga Joan Laporta dey make mouth say dem no ready to sell the guy, the best thing for dem na to sell.

Because if dem no sell the 25 years old Netherland midfielder now, him total salary plus bonus for him remaining contract go reach nearly 90 million euros and na dis kind hooge money naim Barca no need to dey hear. So e make sense make dem hustle sell the problem give Manchester United or anybody else now wey road still clear.

But to do dat, dem must pay the bobo all him outstanding salary of 10 billion naira and na dat money naim dem still dey hustle to meet up.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version