Meet the players

Barcelona don nak £430m release clause inside Christensen and Kessie contract after signing dem free of charge

Published

on

As Barcelona don complete the signing of both Franck Kessie from AC Milan and Andreas Christensen from Chelsea, we don dey hear now say the club don nak heavy release clause of 430 million pounds put inside dem contract. Upon say Barcelona buy dem on top free transfer yet dem church mind no tell dem say dis kind release clause wey dem nak on top dis two players so na akoba adaba.

Andreas Christensen na 26 years old big central defender wey don spend the last 10 years of him career as a Chelsea player. The Denmark player win FA Cup, UCL, Europa League, Club World Cup and European Super Cup with Chelsea before him finally leave the club as free agent.

Franck Kessie na Ivory Coast central midfielder wey don dey play for AC Milan for the past 5 years. Though the bobo start slow, the guy begin show himself as one of the best central midfielders wey dey for Serie A wey make many clubs begin find am. But the bobo decide to stay with AC Milan until him contract expire wey carry am enter market as free agent. Last season, Kessie help AC Milan win Serie A for the first time in 10 years.

Both Ansu Fati and Pedri plus Ferran Torres get €1bn release clause

But as dis two players don finally join Barcelona on top 4 years contract each, we don dey hear now say to leave fit be problem because any club wey wan sign dem must ready to pay sontin wey near dat dem release clause of 430 million unless make dem forget am.

Barcelona and release clause don become 5 and 6 recently because e no get any player wey dem wan sign wey dem no go find way nak one hooge release clause put inside. For instance the club hammer release clause of 1 billion euros inside the contract of dem two young players, Ansu Fati and Pedri. Before then, Messi get release clause of 700 million euros. Gavi get release clause of 100 million euros, Ferran Torres get release clause of 1 billion euros while Aubameyang release clause na 100 million euros.

We know say Barcelona dey find money pass central bank sotay dem don even dey sell all dem TV rights and other things just to fit meet up for transfer window but the way dem jus dey nak release clause inside people contract, e con be like say na only players dem wan to dey use make money now.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version