As e dey Go

Transfer News: Ronaldo don warn United to begin sign players or…., Chelsea wan sign £103m De Ligt

Published

on

For transfer news today, we don dey hear now say Manchester United last season top scorer, Cristiano Ronaldo don dey warn the club say dem better begin sign players like other serious clubs or him go jus vex go find more serious club to join.

According to the matter, Ronaldo don talk to United coachie, oga Erik Ten Hag and him ready to help the coachie achieve him high pressing football. The only problem be say, United no believe say the players wey dey the club now go fit make the thing work. So therefore him want make the club sign new and improved players wey ready to run things anyhow e wan be, to return Manchester United to the top wey dem belong.

But as e be now , e be like say the club no ready to sign players because the kind behaviour wey dem dey show for transfer market so, na alakoba and bambiala behaviour. When top clubs like City, Liverpool, Tottenham and even Arsenal don enter market dey make purchases, United still dey there dey fufu. Na all diswan don make Ronaldo tell some of him paddy dem say if United continue with dis unseriousness, walai talai him go carry all him kaya including all him world best award waka leave the club.

Chelsea wan sign £103m De Ligt from Juventus

Chelsea don dey plan to do igbankwu on top the head of Juventus defender, Matthijs De Ligt as dem don begin ask about the guy. The only problem be say, the bobo marriage with Juventus suppose expire by 2024 and inside the contract, the release clause na 103 million pounds. But Juventus don tell dem make dem no worry, if dem truly need the guy and promise to treat am better than dem treat Lukaku, then we will see what we can do to help una reduce the bride price.

De Ligt get 103 million pounds release clause for him contract

De Ligt join Juventus for 2019 as one of the hottest young players inside Europe da year. The bobo carry Ajax enter UCL semi final as dem youngest ever captain after e carry dem win both Dutch League and cup. But him never really shine laidat since him join Juve and him sef fit don dey reason to leave the club. Chelsea lost both Rudiger and Christensen and dem really need experienced central defenders. De Ligt wey dey just 22 years old go be good long term option.

Barcelona dey price Lewandowski £30m

We don dey hear now say Barcelona don make new bid of 30 million pounds to take sign Robert Lewandowski from Bayern Munich. We also hear say Bayern Munich go reject the offer because na Lewandowski dem wan sell not crayfish and maggi wey go make Barcelona dey price the guy like discount.

Na Robert Lewandowski win FIFA best for 2021

Robert Lewandowski dey vex for Bayern Munich and him don yan immediately season end say na only miracle go make am play for Bayern Munich ever again. But Bayern oga dem say all dawan na story for the gods because him marriage contract remain 1 year and him must complete am whether him like or not. In fact dem don nak am ultimatum deadline say him must return to the club for preseason by July 12 or… Lewandowski na one of the hottest strikers for world today and na him win FIFA best player last year. Clubs like Chelsea and PSG also want am but the bobo don decide to go Barca even agree 3 years verbal agreement with dem.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version