As e dey Hot

See how Romelu Lukaku beg Simone Inzaghi like prodigal son to let am return back to Inter Milan

Published

on

As Inter Milan dey ready to collect Chelsea striker, Romelu Lukaku back on loan, we don dey hear now say Inter Milan been no dey plan to collect the big Belgian egunu back but na Lukaku himself use phone take call Inter coachie, oga Simone Nzaghi, knee down for ground with water for him eyes dey beg the man to sign am back to Inter Milan with immediate alacrity.

According to the tory, na on April 5 wey be Inzaghi birthday and just one day before Chelsea play Real Madrid for UCL, naim Lukaku call Inzaghi to wish am happy birthday. Na after e wish am finish, Oya cut the call na, Lukaku no gree cut call. Na diswan make Inzaghi ask am, young man is there anything else I can do for you? Na then Lukaku begin confess and beg the man say Chelsea don taya am and anything wey him fit do, him ready to do am, make Inzaghi just help am secure him return from Egypt. Ordinarily na Lukaku agent, oga Federico Pastorello naim suppose make da kind arrangement but Lukaku no even send da wan.

Romelu Lukaku no know say dis smiling with Simone Inzaghi during training for Inter Milan go one day turn to begging

Romelu Lukaku join Chelsea from Inter Milan last year (2021) on top 98 million pounds contract. Before then him score 24 league goals to help Inter win Serie A title for the first time in 11 years wey only Juventus jus dey win the thing like say na dem birthright.

But e be like say village people still dey Chelsea dey wait for am because since the guy join the club, bad bad things just begin happen to am. Even to score goals become problem because baba no see him period again. E bad sotay Thomas Tuchel begin forget am for bench, dey use Kai Havertz and Werner instead. The matter worse sotay Lukaku do interview wey him blast Tuchel say the guy no like am, and say him regret why him leave Inter join Chelsea even after him first tenure there end in premium tears.

That interview make Chelsea dem oga dem provoke well well sotay dem nak am fine of 325,000 pounds still ask am to apologise on top. After dat, coachie begin play am for match but the bobo continue to dey play igbakugba and miss chances including one empty header wey him miss the following day after him beg Inzaghi finish against Real Madrid for UCL quarter final.

In fact after dat call, Lukaku no score for the whole of that April and nearly a month after April because him mind don comot from Chelsea. In the end striker wey dem buy with nearly 100m pounds score only 8 league goals for Chelsea. Na diswan make Chelsea finally decide to let the guy go. As e be now no, Chelsea don accept Inter Milan loan fee of  8.5 million pounds and anytime from now, Lukaku fit return back to Inter on loan.

 

1 Comment

  1. Składnica Wiedzy

    July 14, 2022 at 5:04 pm

    I found your blog website on google and check just a few of your early posts. Continue to keep up the very good operate. I simply extra up your RSS feed to my MSN Information Reader. Seeking ahead to studying extra from you afterward!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version