As e dey Go

Transfer News: Tottenham agree marriage contract with Bissouma, Real Madrid unveil dem new wife, Tchouameni

Published

on

The first transfer news wey we go nak una dis morning na the news of Tottenham after we don hear say dem don finally agree to marry Yves Bissouma from Brighton on top 5 years contract wey everything inside the bride price list go cost dem about 22.5 million pounds.

Bissouma wey dey 25 years old na solid midfielder from Mali wey don join Brighton from Lille since 2018. The bobo start 25 EPL matches for Brighton last season. The guy good sotay Arsenal don dey pursue am upandan dey try toast am since last year but e be like dem alaroro behaviour make the bobo no gree for dem wey make dem run go sign Lokonga instead.

Tottenham really dey prepare for life inside UCL as dem jus dey sign players left right and centre. Dem coachie, Antonio Conte don first collect Ivan Perisic and Fraser Forster on top free transfer and now dem don pay to collect Bissouma from Brighton.

Real Madrid unveil €100m Tchouameni

Real Madrid don finally unveil dem new wife, Aurelian Tchoumeni make everybody see am say the money wey dem spend to marry her no be waste. Real Madrid pay bride price of €100 million to take marry dis young wife comot from Monaco straight to Santiago Bernabeu.

Real Madrid don unveil Aurelien Tchouameni

Tchouameni wey dey just 22 years old na one of the best young players for the whole world. The central midfielder play a total of 50 matches for Monaco last season. When dem dey unveil am, the bobo wey don become France national team player confess say Mbappe try to toast am make him forget Real Madrid and join PSG but him tell Mbappe say no be everybody be like am wey no like better thing.

Dembele wey Barcelona buy £120m go leave on top free transfer

Finally for transfer news, Barcelona winger, Ousmane Dembele don reject one final toasting from Barcelona and right now, the bobo don ready to abandon the club go join another one on top free transfer. We don dey hear say Chelsea don already dey toast am with plenty sweet sweet talk and na da wan even make the bobo head dey turn wey make am no wan gree sign new contract with Barca. No forget say Dembele and current Chelsea coachie, Thomas Tuchel don work togeda before for Dortmund and e fit be wetin make am dey seriously consider Chelsea be dat.

Dembele join Barcelona from Dortmund for 2017 on top £120 million pounds contract but since him come, the bobo never see him period as him just dey fumble anyhow. If no be injury wey dey do off and on for him matter sotay the guy don get special bed for Igbobi, e go be disciplinary problem. But Dembele game suddenly catch fire again under Xavi as Barca coachie and although Xavi want am to stay, be like the bobo don finally see greener pastures elsewhere.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version