As e dey Go

Transfer News: Arsenal don agree to sign Fabio Vieira from Porto, Man City dey eye Cucurella

Published

on

For transfer news dis morning, we fit confirm give una say Arsenal don finally begin spend dem money inside transfer market after the club agree to count 30 million pounds inside Ghana-must-go to take sign Fabio Vieira from FC Porto on top 5 years marriage contract.

Vieira na 22 years old Portuguese creative midfielder wey many people don dey hail as the next Luca Modric. The boy score 7 goals plus 16 assists last season to help Porto win Portuguese League. And when dem check all the Arsenal players record for last season, no single one of dem, from Saka to Odegaard and even Nketiah and Smith-Rowe, none of dem get goal contribution reach Vieira and na wetin don make Mikel Arteta rush go pay 30 million on top dis guy head so.

Although Fabio Vieira get release clause of 42.6 million pounds, we hear say Arsenal still price the guy like market woman dey price tomatoes for Mile 12 wey make Porto bring hand down to dat 30 million. Vieira go enter London later today to complete him medical and join Marquinhos and Matt Turner as the new players to join the club. We can only hope say dis Vieira live up to the standard of the former Vieira of Arsenal.

Manchester City dey eye Cucurella of Brighton

We don dey hear now say Manchester City don dey eye Cucurella the way sugar daddy dey eye Slay Queen wey enter him eyes for night club. Manchester City never really get solid LB since wey Benjamin Mendy go land himself inside sexual assault case and Pep Guardiola no trust Zinchenko too much like dat.

Marc Cucurella wey Man City don use scope dey toast like sugar daddy

Cucurella shine well well for Brighton last season after dem sign am from Getafe sotay the guy win Brighton Best Player of the Season. Cucurella graduate from Barcelona academy wey be La Masia. Brighton no go like sell the guy because him still get 4 years on top him contract but the problem be say, once Man City want player, dem be like Sugar Daddy wey go jus use money take collect small boys babe. The price tag on top Cucurella head na about 50 million pounds.

Barcelona oga dem wan sell some part of the club to fit sign players

We don dey hear now say Barcelona oga dem don agree to sell some parts of the club as well as some TV rights so dat dem go fit raise money to fit take sign players for market. Una remember say Barcelona don broke sotay dem dey even nak players salary cut anyhow jus to fit meet up. On top of dat dem still dey owe igbese of about 1.6 billion euros wey PSG oga dem no dey ever stop to remind dem say dem be onigbese club.

Barcelona wan raise money to fit take sign Lewandowski

According to dis sell-sell tory, Barca go sell nearly 50% of dem retail business wey be Barcelona Licensing and Merchandising, BLM. On top of dat, the club wan sell up to 25% of dem TV rights for the next 20 years, make somebody pay sharp sharp and collect am as e dey hot. The oga dem believe say selling dis 2 things go help dem raise up to 700 million euros to take sign players like Lewandowski, Kessie and the others wey dey enter dem eye.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version