As e dey Hot

Transfer News: Barcelona want €100m blood money for Frenkie de Jong as Arsenal sign £3m Brazilian

Published

on

For transfer news this morning, we fit confirm give una say Barcelona don reject Manchester United bride price of 70 million euros to take marry Frankie de Jong come Old Trafford. United wan pay 60 million down plus extra 10 million for add-on and bonus but Barca don tell dem say the player cost pass like that.

The new Manchester United coachie, oga Erik ten Hag don swear say him must sign Frenkie wey him play with for Ajax come Old Trafford because na players like that him need to move the club go permanent site. But Barcelona don tell am say as him don see wetin him like no need to dey do alaroro on top and because of that, dem don nak United igbankwu list of 100 million euros.

But Barcelona go likely sell the boy if United manage top the money to around 80 or 85 million euros.

Arsenal don sign 19 yrs old Brazilian winger from Sao Paulo for £3m

Arsenal don complete the signing of one 19 years old midfielder, Marquinhos from Sao Paulo. According to wetin we hear, na only 3 million pounds Arsenal pay as bride price to take marry this boy straight from Brazil. Although Arsenal never announce the signing, the plan na say the boy go join the team for preseason.

Marquinhos from Sao Paulo

Arsenal still dey pursue another Brazilian, Gabriel Jesus although we hear say as bigger clubs wey dey Champions League like Chelsea and Real Madrid don chook mouth for the Gabriel Jesus matter, Arsenal no go even see second for the matter. But at least dem don sign one Brazilian so dem mind rest.

Manchester United don offload full team of 11 players

Manchester United don offload 11 players, meaning say na full amount of players wey reach to start match be that. United get many decent players wey jus dey collect salary even when dem no dey see match play and dem don use dis opportunity take troway many of dem.

Last season na disaster for Manchester United

Players wey United offload include senior team players like Paul Pogba, Nemanja Matic, Juan Mata, Edinson Cavani, Jesse Lingard, Lee Grant and Paul McShane. The other players na young players so no need to mention dem. Players like Brandon Williams, Anthony Martial and Donny van de Beek go return from loan and e be like new United coachie, oga ten Hag get big plans for dem.

Chelsea don release 4 players including Christensen and Drinkwater

To complete our transfer news this morning, Chelsea don release 4 of dem senior players make dem go find another club wey go marry dem well. Among those players na defender, Andreas Christensen wey Barcelona don dey toast am since. As him contract don expire so, Chelsea kuku decide not to renew am again, even though dem dey short for central defence after Rudiger comot go join Real Madrid.

Other players wey discharge from Chelsea na Danny Drinkwater wey dem sign with 35 million pounds wey later flop sotay dem jus dey send the guy go loan upandan like young player, Charly Musonda wey don dey complain of playing time since forever, and 24 years old Jake Clarke-Salter wey play only 3 matches for Chelsea senior team.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version