As e dey Go

“Real Madrid use luck take win Champions League, no be say dem too good”- Manchester City oga

Published

on

My people e be like say dis Champions League wey Real Madrid win still dey pepper some people for body, especially some of the people wey dem beat jabo for road. Because Manchester City CEO, oga Ferran Soriano don come outside without provocation begin hala say:

That Champions League wey Real Madrid win, walai talai sumobinlai, na lucky den take win am. You sef check am, PSG suppose beat dem, Chelsea suppose beat dem, Liverpool suppose beat dem for the final. We Man City don beat dem finish if no be say we go lose guard allow dem score 2 late goals. All dis matches na lucky escape naim Madrid just dey escape.

Man City CEO, oga Soriano say him no dey sorry to talk say na only luck naim Real Madrid take win UCL because all the match wey dem play, no wan wey na dem play pass

Una remember say Real Madrid win dem 14th UCL last season after dem manage beat Liverpool 1-0 for the final. And many people go argue say if no be Thibaut Courtois wey turn himself to saviour of the world begin save goals like say dem swear to put am for firing squad if one goal enter, Liverpool for win am.

Before then, for the round of 16, Karim Benzema score 17 minutes hat trick to help Madrid come from 2-0 down beat PSG 3-2 on aggregate. When dem jam City, City dey win 5-3 on aggregate after 90 minutes of the semifinal second leg before Rodrygo score 2 late miracle goals to make am 5-5 carry the match enter extra time wey Benzema convert PK to help Madrid win 6-5 on aggregate.

Na all dis tin don make City CEO don dey shake head say, mbanunu, wetin Real Madrid achieve is not ordinary and something must involve. According to oga Soriano: Dis Real Madrid team no strong na. We don see some former Madrid team wey strong pass diswan 100 times yet dem no get that luck to win UCL. But diswan, dem just dey okay but the luck wey dem get strong pass the team.

Oga Soriano also yan say City no be like PSG wey dey in a hurry to win UCL because everything get him own time and season and when City time reach, the thing go jus happen like film, the same way Real Madrid own happen. Him yan say dem target na make only dem just continue dey win EPL dey go because na dem own bread and butter plus ewa agoyin naim be dat. The day wey City luck finally shine, UCL go come.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version