As e dey Hot

‘Mbappe just use Real Madrid take dey catch cruise, him no ever plan to join dem’- PSG Presido

Published

on

France and PSG golden boy, Kylian Mbappe don reject Real Madrid choose PSG instead but the quarrel between the two clubs on top him matter still dey hot. And now, PSG presido, oga Nasser Al-Khelaifi don come outside dey kala Real Madrid say him always know say Mbappe no dey go anywhere and all that romance wey him dey do with Real Madrid jus be like when woman dey pretend to like another guy just to make him main guy jealous. In other words, na cruise Mbappe use Madrid take dey catch.

Remember say Real Madrid and dem fans been dey happy after dem claim say Kylian Mbappe don agree to sign for dem once him contract with PSG end last season. But e con be dem like movie magic when the bobo do about-turn say him no want Madrid again, and him prefer to stick with the Sugar daddy wey him dey with. Na diswan make everybody for Real Madrid para dey call am betrayer, sotay Madrid presido, oga Florentino Perez call Mbappe small boy wey let money distract am from him dream of playing for Real Madrid.

Mbappe rejection pain Real Madrid sotay dem fans begin print polo on top the guy matter.

But now, PSG presido don dey clear dem say Mbappe no ever get any nonsense dream like dat not even when him get high fever. In fact e go be very bad nightmare if to say the 23 years old World Cup winner leave PSG go play for Real Madrid. According to oga Nasser:

“Mbappe na our player from today till tomorrow and if Madrid like make dem cry till next week, dem tears no go change anything. Dem dey complain say we use money take cover Mbappe eyes but dem no wan confess say dem even offer the boy more money pass us. How much we later give the boy? Only 126 million pounds. Oya guess how much Real Madrid take dey beg am. 155 million. If to say Mbappe eyes dey money, na Madrid him for follow. But we know wetin Mbappe want and we know say wetin we dey give am important pass gold and silver that’s why him bone Real Madrid and other clubs and decide to stay with us.”

Kylian Mbappe don agree to sign for Real Madrid wey don dey pursue am for the last 2 years but according to Madrid presido, the bobo do U-turn just 15 days before him for sign the contract. PSG offer the boy new 3 years contract wey go expire for 2025. Mbappe become one of the highest paid players for the whole world as him go dey collect salary of 650,000 pounds every week. PSG also pay am the full sign on bonus of 126 million pounds.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version