As e dey Hot

Real Madrid don unveil Antonio Rudiger, nak am Number 22 jersey

Published

on

Real Madrid don finally unveil Antonio Rudiger as dem new player after collecting the guy on top free transfer from Chelsea. Rudiger complete him medical earlier today and Madrid no waste time to nak am jersey number 22 and quickly unveil am to dem fans.

Antonio Rudiger spend 5 years as Chelsea player and him performance those 5 years dey off and on like Nepa light. Former Chelsea coachie, oga Frank Lampard forget Rudiger for bench sotay the guy begin reason him life choices. But na when Thomas Tuchel land naim the Coach dust Rudiger from bench begin use and starting CB sotay him help Chelsea win UCL last season. Chelsea try nak am new contract then since na only 1 year remain for him contract but the bobo don already decide to leave the club although him never know where him dey go next.

Antonio Rudiger with Real Madrid presido, oga Florentino Perez

According to Rudiger, many other clubs wan sign am, some of dem even dey promise am money wey pass the 315,000 pound per week wey Madrid wan pay am. But na since April when Ancelotti call am personally and talk to am naim him don seal him mind say na either Madrid or nothing. Even when Chelsea dey beg am with new contract and when Barcelona dey try toast am, him simply tell him agent say na either Real Madrid or nothing.

During the unveiling, Antonio Rudiger also shalaye say him support Real Madrid for the Champions League final wey dem play against Liverpool because by then him don sure say him dey port go Bernabeu. According to am: “e sweet me well well as Madrid beat Liverpool because by then I don play those bastids for two finals, FA Cup and League Cup yet dem beat me two times on top penarity. So I jus dey pray make Madrid help me revenge and na wetin happen be dat. The totori my bele.”

Antonio Rudiger na solid defender wey Real Madrid go enjoy well well because the guy strong, fast, good for air, and e get dat kind skoi-skoi wey dey very important for central defender to dey get once in a while. Real Madrid central defence no too solid because Na only Alaba be the established name there. Since dem sell Ramos dem never really get dat solid egunu for central wey go dey rugged things for dem. Players like Nacho and Militao dey try but if we check am, dem no reach. Na where a signing like Rudiger dey very important and why Madrid nak release clause of 342 million pounds inside him contract.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version