As e dey Hot

Police oga for Paris don apologise for using teargas and lying on top Liverpool fans head

Published

on

The oga kpatakpata of police inside Paris, France, oga Didier Lallement don come outside with two knees for ground dey beg Liverpool fans say make dem no vex for the teargas wey him officers take baptise dem outside stadium just before that Champions League final between Liverpool and Real Madrid.

Oga Lallement say him no mean to cause the fans so much pain but na village people wey dey work overtime naim cause am. The police oga admit say na him give him boys permission to use teargas take follow the fans up because based on the information wey him get, the situation on ground require serious vawulence and not peace.

Oga Didier Lallament

According to officer Lallement: “We don fail everybody including the supporters and even our country. We no suppose use vawulence take run people down and the fact say na wetin happen show say we no try at all. I wan apologise to Liverpool fans, as a police officer, my work na to prevent vawulence and at that time, I no see any other option than to use teargas.”

The police oga also confess say him lie about fans without ticket…

The police oga also confess say that lamba wey him drop say up to 40,000 Liverpool fans wey no get ticket wan enter stadium na fake news because him no even get the information of how many Liverpool fans enter Paris for the final talkless of to know how many of dem buy ticket.

According to oga Lallament: That number wey I drop, make I no lie, I no even know how e take enter my head because no single evidence to show say 40,000 supporters no get ticket. Na some police officers and danfo drivers give me the information and instead of to verify am, I rush go use am like dat. The number of fans wey dey the gate no even reach 5,000 but e no matter now, wetin matter be say I dey sorry, make una forgive me.

As una know, Liverpool later lose the final to Real Madrid after the whole gbege for gate make officials to delay the match for almost 30 minutes sotay even when one fine babe begin sing and dance for opening ceremony, fans begin boo her say na ball dem pay to come watch not bum-bum.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version