As e dey Go

Barcelona wan sign Harry Maguire as part of De Jong deal but Manchester United no gree

Published

on

We don dey hear now, say Barcelona drop bid to sign Harry Maguire from Manchester United but United coachie, oga Erik Ten Haag no gree. According to the tory, Barcelona wan collect the United skippo as part of the deal wey United wan take sign Frenkie De Jong from Barcelona.

Manchester United really serious to sign De Jong from Barcelona because Ten Haag don point am say na him Number 1 priority be dat. The coachie and the midfielder don work togeda before for Ajax so dem no go hard to understand each other.

We don dey hear say both United and Barca dey reason the payment of 55 million pounds as signing fee and additional expenses wey fit carry the money enter around 68 million pounds. Na for the middle of the negotiation naim Barca remember say dem get central defensive problem so dem use scope ask United to release Maguire as part of the deal but United no even think am.

Manchester United fans no gree Maguire drink water drop cup last season as dem jus dey blame am for all the bonanza wey United defence jus dey do last season

Harry Maguire become the most expensive defender for the whole world after Manchester United count 80 million pounds inside Ghana-must-go to secure the bobo signature from Leicester City. But since then the guy no dey too see him period as him form just dey fluctuate like Nepa half current.

The thing kuku worse kpatakpata last season wey United defence just dey dash opponents goal like say dem dey do giveaway. And as the defence dey fumble na so Maguire errors just dey increase wey make fans begin provoke dey threaten coachie to drop am. The matter worst sotay some fans go plant time bomb for Harry Maguire house because dem no want am to play for dem again.

Therefore e no go dey surprising if many United fans go like make the guy getat from the club but the new United coachie don clear everybody say Maguire no dey go anywhere and in fact, the bobo na key player for dis United set up. But we no con know weda na Maguire go still be United skippo for dis new season because we hear say dem dey try use the captaincy take toast Cristiano Ronaldo to remain for United.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version