As e dey Hot

“Na only mumu dey talk say Ronaldo better pass Messi”- Marco van Basten

Published

on

My people dis Ronaldo versus Messi bants don enter new level of vawulence after football legend, oga Marco Van Basten come outside today dey yan say: “if you see anybody wey open mouth wey him take dey chop amala take talk say Ronaldo better pass Messi, just know say dat pesin no know any single thing about football.”

According to Van Basten wey many people dey see as one of the best players to ever kick ball, no be weda say Ronaldo no good o. The bobo good die. But e get level wey pass level and the level wey Messi dey, Ronaldo still dey learn work there. Therefore make anybody no mistakenly compare dat kind comparation again make him and Van Basten no go get problem.

Marco Van Basten

For the eyes of many people today, Ronaldo and Messi na 2 of the best players to ever play football for this life. And as dem two good reach, na so dem supporters take divide both among players and among fans the same way Peter Obi OBIdient supporters divide from Tinubu BATified supporters. And as dem divide so, na so dem dey take every opportunity to show each other pure vawulence when dem begin argue who be the GOAT between dem.

But Van Basten don indirectly dey tell Ronaldo fans to drink ice water, kam dan and forget about dat talk because Ronaldo no be Messi mate. According to the man: una don see where Messi dey play ball? If una never watch am well make una go watch am. Da guy no get rival. The things wey him dey do, the magic wey him dey perform, no other player for this world fit try am. Player like Ronaldo dey come once every year or every 2 years. But player like Messi, na once every 100 years we dey see dem. Diswan you go know say as dem born dem, ball follow dem come outside from dem mama bele.

Oga Van Basten finally scatter the whole table kpatakpata when him yan say: forget say I dey famz Messi like dis o, as far as I’m concerned, dat bobo no even follow for the Top 3 footballers wey don play football for dis life. Because to me, if I wan count the top 3 footballers to ever play football, I go first count Pele, Maradona and Johan Cruyff before I go even reason whether e get any footballer wey dem dey call Messi. Yes the guy win 7 Ballon d’Or and all, but when e comes to ball, Messi no even be number 1 for Argentina.

My people Van Basten to dump both Ronaldo and Messi inside potor-potor. Abeg shay the bros yan well or not?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version