As e dey Hot

FIFA hammer £143,000 fine on top Senegal say dem fans flash green torchlight for Salah face

Published

on

As e dey hot, we fit konfam give una say FIFA don hammer fine of 143,000 pounds on top the head of Senegal after dem investigation show say true-true Senegal fans behaviour no too pure after them shine plenty green-green torchlight inside the face of Mohamed Salah jus before him play dat penarity for dem World Cup qualifying second leg match wey shele for Senegal.

Una remember say after the match, Egypt players and officials give report say wetin dem eyes see for Senegal, walai talai dem mouth no fit talk am finish. Dem say na from their journey from hotel to stadium wey far pass from Jerusalem to Jericho naim Senegal fans don begin attack dem dey stone dem bus with bottle, rotten egg, stone, anytin wey fit wounjure human being. When dem finally reach stadium say make dem warm up, again fans begin stone dem dey insult dem even call dem all kind of racist name.

During the match about 100,000 green torchlight dey follow any Egypt player wey hold ball and after the match, upon say Senegal win, the fans still attack dem again sotay dem need special forces to take protect Salah. Na all dis tin naim FIFA investigate finish see say true-true Senegal fans na real agbero fans wey commit wetin onyibo dey call disgraceful conduct by flashing torchlight inside Egypt players eyes, invading the pitch after match and even carry one racist banner enter stadium.

All diswan show say Senegal FA no fit control dem fans behaviour wey make dem hammer dem dat fine of 143,000 pounds wey if Aboki change am for you, e go be 74.3 million Naira. Also Senegal go play dem next home match for empty stadium.

My people how una see dis kind fine wey Fifa don nak Senegal so?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version