Meet the players

As Gabriel Jesus plan to win many trophies for Arsenal, how many Brazilians recently don win trophy for Gunners?

Published

on

Arsenal don complete the signing of Gabriel Jesus from EPL Champions, Manchester City on top 45 million pounds contract. Immediately the bobo land for Emirates na so dem carry Number 9 jersey nak am for unveiling still carry am go Emirates rooftop make him go pose him Jesus the Saviour pose.

And now, the Brazilian don come outside dey yan say no be shere-shere him come do for Arsenal o because as him dey so, him mission for Arsenal na to win trophies so dat when him finally leave the club, dem go use trailer take pack trophies dey escort am comot.

True true, Gabriel Jesus and trophies na 5 and 6. For dis Manchester City wey him just comot from so, the bobo win 4 EPL, 4 Carabao Cup and 1 FA Cup inside only 5 and half years for there. Before then, him don win Brazilian League and Brazil Cup with Palmeiras inside Brazil. For national team nko, Gabriel Jesus don win Copa America as well as Olympic gold medal. So if na for trophy matter, Gabriel Jesus don carry first well well.

Although Arsenal na club wey get one of the biggest trophy cabinet for England, recently the club no too dey see dem period like dat again. While Arteta carry dem win FA Cup for the first half season of him government, since then The Gunners never even near anything wey look like trophy.

The last time wey Arsenal win EPL na 2004 wey dem do invincible by going the full league season without losing one single match. But dat na nearly 20 years ago and pikin wey dem born then don dey hustle for PVC to vote for 2023 election. Although dem win some FA Cups and reach the final of League Cup, UCL and Europa League, dem eventually no win any of those trophies.

For a player like Gabriel Jesus wey don dey used to winning trophies, una sure say na the right place him come so? More importantly, since after Edu and Gilberto wey be Brazilians wey follow Arsenal run dat unbeaten season, how many of the Brazilians wey come after dem don win trophy for Arsenal?

How many Brazilians don play recently for Arsenal and which one don win trophy for dem?

Denilson (2006-2011)

Denilson no win any trophy for Arsenal after 5 years

Denilson Pereira Neves join Arsenal for August 2006 from São Paulo. Arsene Wenger wey sign am so believe in am sotay him describe the bobo say if you mix Gilberto and Rosicky togeda, wetin you go get na Denilson. Denilson don captain all him age grade football until him join Arsenal.

But after 5 years for Arsenal (minus 2 years loan), Denilson don play 153 matches for Arsenal, score 11 goals, and win 0 trophies for Arsenal. Dis na bobo wey don win Club World Cup (2005) and Copa Libertadores (2005) with São Paulo before him join Arsenal. Denilson play 2 League Cup finals (2007 and 2011) for Arsenal but him no win any of dem. Denilson later win Copa Sudamericana (2012) and UAE League Cup (2016) with São Paulo and Al Wahda.

Julio Baptista (2006-2007)

Julio Baptista play for Arsenal on loan from Real Madrid

Julio Baptista na big Brazilian striker wey many people expect to do big big things for him career. Immediately him enter Europe for Sevilla, Baptista score 50 goals in just 2 seasons. Na diswan make Real Madrid rush go buy am carry Number 8 nak am, not knowing say the bobo fuel don finish. After 2 years for Madrid wey him score only 11 goals, dem quickly ship am on loan to Arsenal.

Arsene Wenger na magician and even though him magic work small for Baptista coconut head wey make the guy manage score 10 goals for 35 matches, in the end him no manage win any single trophy for Arsenal even though him play the 2007 League Cup final. Baptista win La Liga with Real Madrid,  Brazilian league (2013 and 2013) with Cruzeiro, 2 Copa America (2004/2007) with Brazil and 2 Confederations Cup (2005/2009) with Brazil national team.

Andre Santos (2011-2013)

Arsenal carry Number 11 nak Andre Santos thinking say him go score the kind goals wey him score for Fenerbahce

Arsenal sign Andre Santos as one of the rush-rush final day madness transfer of August 31, 2011 after Manchester United beat dem 8-2 for EPL. Before then, Santos wey be left back don score 10 goals for 52 league matches for Fenerbahce to make am the highest scoring defender for Turkish league.

Apart from that, Santos don win Brazil Cup (2009) with Corinthians, Turkish League (2011) and Turkish Super Cup (2009) with Fenerbahce, then Confederations Cup with Brazil national team. But when him come Arsenal, after playing 33 matches and scoring 3 goals, Andre Santos no win even ordinary Stainless Cup for Arsenal.

Eduardo da Silva (2007-2010)

After scoring 73 goals for 105 league matches for Dinamo, Arsenal rush go buy Eduardo

Eduardo da Silva na wucked leftie striker wey Arsenal fans love because dem believe say the guy dey give 100% whenever him enter pitch to play. Dem also believe say if no be injury wey wreck him career turn am to iron condemn, the bobo for do well for Arsenal. Although Eduardo no play for Brazil choosing to play for Croatia instead, everybody know say the bobo na Brazilian and das why we add am for dis list.

After scoring 73 goals for 105 league matches for Dinamo Zagreb, Arsenal rush go sign am even nak am Number 9. But after scoring 21 goals inside 67 matches for Arsenal, Eduardo no manage to win any trophy for the 3 years wey him play for The Gunners. Before Arsenal, Eduardo don win Croatia league, Croatian Cup and Croatian Super Cup 3 times each with Dinamo Zagreb. After Arsenal, him win Ukraine league 4 and Ukraine Cup 4 times each and Ukraine Super Cup 3 times with Shakhtar. Him also win Poland League and Polish Cup with Legia Warsaw.

Gabriel Paulista (2015-2017)

Gabriel Paulista naim win trophy pass for Arsenal out of this list

When Arsenal sign Gabriel Paulista for 2015 and dem fans first watch am play, the ruggedness and the toughness wey the guy bring come really sweet everybody because e don tay wey dem get da kind hot head defender last. But na matter of time before dem see say na only ruggedness the guy rugged him no too get ball IQ laidat.

But dat wan no stop Gabriel Paulista from becoming one of the most successful Brazilians for Arsenal since invincibles. The bobo win 2 FA Cups (2015/2017) and 1 Charity Shield (2015) with Arsenal. In fact na Arsenal open him trophy cabinet because him never win anything before him join Arsenal. And since him leave Arsenal, na only Copa del Rey (2019) him don win with Valencia.

David Luiz (2019-2021)

David Luiz na senior man. Make we no talk pass laidat

David Luiz na Seniorman for dis game and we no even need to dey talk about am because na one of the most-decorated Brazilians to ever play for Arsenal be dis. Before him use coconut head take force himself comot from Chelsea go join Arsenal, e no get any club for Europe wey him play wey him no win trophy.

For Benfica Luiz win Portugal league (2010) and 3 league cups. For Chelsea him win EPL (2017), 2 FA Cup, and 1 Champions League. Luiz continue the trophy winning for Arsenal as him collect FA Cup and Charity Shield (2020) for The Gunners. Na only Luiz actually win trophy for Arsenal for dis list.

Willian 2020-2021

Willian own matter be like say na village people do meeting for him head decide to lead an astray. Because the bobo na high chief for Chelsea sotay the last season before him leave naim be dem highest goal contributor. Chelsea self wan keep am but Arteta somehow convince am say him get agenda to win UCL in 3 years. Of course him just win FA Cup and Charity Shield so him must serous.

Na diswan make Willian run go sign 3 years with Arsenal. But no be wetin Willian expect naim e see for Arsenal and no be wetin Arsenal expect dem see for Willian. After scoring only 1 goal for 37 matches wey him play for the full season, Baba no win even kpangolo for Arsenal.

Before Arsenal the bobo don loot trophies full everywhere. For Ukraine him win 4 League, 4 league cups and 2 Super Cup and 1 Uefa Cup. For Chelsea him win 2 EPL, 1 FA Cup, 1 league cup and 1 Europa league. For Brazil him win Copa America.

 

 

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version