As e dey Hot

Osimhen dey the same level with Drogba but him too dey dive – Mourinho

Published

on

As Italian Serie A dey resume this weekend, Roma coachie, oga Jose Mourinho don come outside dey yan him mind about Napoli star player, Victor Osimhen say true true the boy dey the same level with Didier Drogba. Him only problem na say the bobo too dey dive.

Mourinho na one of the top coachies for world football wey many people respect because him always dey candid. Africans love am specially because him dey always give black players opportunity to make name for themselves.

For Chelsea, the man turn players like John Mikel Obi, Michael Essien and Didier Drogba into world class players. For Roma now, him dey work on 20 years old Ghana boy, Felix Afena-Gyan and Naija blood, Tammy Abraham.

So when them ask am whether him go like to get a player like Victor Osimhen to join him team, Jose Mourinho say yes, although e get one character wey him for like make the Naija Number 9 change:

“If I dey club wey get plenty money, for sure, I go buy Osimhen. Why not? The boy dey the same level with Didier Drogba right now. But the only problem I go get with am na say him too dey dive. Drogba no dey dive. The guy solid.”

Osimhen na one of the hottest strikers for the world today

Jose Mourinho also warn Osimhen say if him plan to play for Premier League then him better dead that character of diving because Seria A fit dey overlook those things but for EPL, no matter how you good, if you be diver, fellow players, coachies and even refs, none of them go respect you.

Victor Osimhen na one of the hottest strikers in the world today. The Super Eagles striker dey top Serie A goalscoring table with 21 goals and league still remain plenty. Napoli dey play AC Milan for home on Sunday.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version