As e dey Hot

Chelsea fans dey beg Eva Carneiro to come back save them from injury

Published

on

As injury continue dey carry Chelsea dey go where them no know, many Chelsea fans don enter social media begin beg them former team doctor, madam Eva Carneiro make she come back come help them before injury finish them kpatakpata.

Na Andres Villas Boaz employ Eva Carneiro as Chelsea team doctor for 2009. And she remain there until 2015 when she sack herself after Jose Mourinho use abusive word on her, call her daughter of a bitch.

This na after she enter pitch to go treat Eden Hazard when Chelsea dey play one man down due to red card. So as she don enter, Hazard must follow her leave pitch meaning say Chelsea go come dey 2 man down for the time being. Na wetin make Mourinho provoke nak her that insult wey lawyers say na sexist.

Eva Carneiro and Jose Mourinho quarrel big quarrel wey make her provoke leave Chelsea

Since she pack all her bags and baggages collect her £5m payoff leave Chelsea, the club don dey suffer different injury crisis. But none of them worse pass the current one as up to 10 Chelsea players dey for Igbobi dey receive treatment.

Yesterday both Raheem Sterling and Pulisic join them teammates like Reece James, Mason Mount, Wesley Fofana, Ngolo Kante, Edouard Mendy, Armando Broja, Ben Chilwell, and Ruben Loftus-Cheek for hospital bed. That na almost one full starting line up and na wetin don make Chelsea fans begin beg Eva Carneiro to come back and save them.

The fans enter her DM for Facebook and Twitter, enter her WhatsApp, enter her Telegram, some even call her for phone and send her email begging her to return and save them from injury because this one don pass them power.

Many fans believe say as a woman doctor, she get magic touch wey dey give men healing. Eva Carneiro self don kuku reply say; let’s go! Meaning say if Chelsea call her back, she fit consider to return.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version