As e dey Hot

Premier League fit begin allow player wey dem substitute to enter game back

Published

on

My people we don dey hear say Premier League don dey plan new rule to allow player wey dem don substitute due to concussion injury for head to enter the match again.

Una know say the new football rule allow for one extra change on top the new 5 changes in case a player suffer from head injury wey dem dey call concussion. But now, EPL want make dat concussion substitute be temporary substitution.

According to how the thing go work, if a player suffer concussion injury, them go substitute am put someone else first for the next 15 minutes.

Them go use that 15 minutes take check the player wey get the concussion well and if all is in order, them go remove the player wey replace am and allow am return back to the match.

As e be now, EPL dey argue say most times, coaches no dey want to lose them important players or scatter them plan so dem go likely ginger make the player wey suffer concussion continue.

Iran goalkeeper suffer head injury during them World Cup match against England but them no substitute am until 10 minutes later

A good example na Iran keeper, Alireza Beiranvand wey play on for 10 minutes during them first World Cup match with England after one wicked head clash wey be like where 2 danfo jam each other. The coach no gree remove am even though him no get himself again.

So Premier League wan make sure before any player fit continue, dem go don use their own doctors take check am for full 15 minutes and if him body still dey alright to continue, them go put am back for the match. If not, na from there straight to hospital.

But as e be now, FIFA no like the package. According to them, the arrangement wey dey down already make sense. Any player wey suffer head injury, dem go give him team extra substitution wey them dey call concussion substitute.

But no be FIFA go tel EPL what to do about rules. So right now EPL dey wait for IFAB to give them go ahead to start this parole. Once IFAB approve am, Premier League go begin use am starting from next season.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version