As e dey Go

Wetin be dis ‘semi automated offside’ wey FIFA wan launch for Qatar 2022 World Cup?

Published

on

We don see different different kind of technology wey FIFA carry enter football. From goal line technology wey dey show refs say ball wey be goal don cross the goal line, to VAR wey referee take dey decide many things like penarity, offside red card and one other one wey dem dey call robot referee wey no even involve any single robot.

While some of dis technology like VAR dey cause kassala, others like goal line technology go clear your doubt sharp sharp. But now, FIFA don dey plan to launch one new technology wey dem dey call the semi automated offside technology (SAOT) for Qatar World Cup 2022. The work of dis technology na to help VAR officials reduce the time wey dem take dey check offside.

Una dey watch ball and una know say na offside decision naim dey waste time pass for VAR. Dis na because those two lines wey you dey see, na the officials dey try use dem hand take draw am for the computer. So when offside tight like dat, the thing dey waste time well well. And apart from the time wasting, the VAR sef don too cause plenty wahala wey don make some people feel say the VAR dey kill the game of football.

With dis new semi automated offside technology, VAR officiating go dey easier

Sometimes sef e dey take like 70 seconds to pause the video when the player wey pass the ball pass am and then to begin mark the 2 offside line. But with dis new semi automated offside, na only 25 seconds e need from the time wey the offside happen to decide whether na really offside.

How the semi automated offside go work

The most important thing about dis technology be say no be manual dem go take dey rule line again because na one technology wey dem dey call artificial technology go takeover everything. First and foremost dem go chook one sensor inside the Adidas “Al Rihla” World Cup balls. Dis sensor go dey record up to 500 different movement of the ball every second. Na dis censor go show the computer exactly when dem kick the ball.

Secondly, dem go put one special mapping camera to dey follow every player so dat the computer go know exactly where every player dey at every time. Na diswan the computer go take know exactly where the player dey at the exact time wey dem kick ball.

So immediately dem press pause, the artificial intelligence go just solve the maths inside the computer and quickly tell the VAR officials who dey off and who dey on. No matter how the offside tie wrapper reach, whether na ordinary offside or offside wey involve more than 1 player, whether na dat kind confusing offside wey dey involve keeper or even the one wey be interference, all of dem no suppose pass between 15 to 25 seconds for the computer to decide.

FIFA don dey test dis technology small small for the past 3 years, with the final testing wey be for the last Confederation Cup wey shele for February inside Qatar. The same way wey una wey dey watch the match for house dey see VAR offside line na so una go dey see diswan too except say instead of normal screen, na 3D screen naim you go dey see so nobody go say dem no see am well. And na for World Cup naim FIFA go launch am full.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version