As e dey Hot

Qatar don ban gbenshing and public kissing for 2022 World Cup except na married people

Published

on

My people wetin no fit happen for dis Qatar 2022 World Cup never exist because the host country don come outside dey warn fans and even players wey dey come for the competition say anything wey be gbenshing, abeg abeg, if you like yourself, make you no try am there. Because if you try am, na 7 years of your life naim you just wan waste inside Kirikiri and trust me, Qatar no dey show any mercy.

According to the Qatar Supreme Committee on top the World Cup matter, Qatar na Islamic country wey no dey accept nonsense no matter who you be or where you come from. And for Qatar law, sex before marriage na abomination and anybody wey try am dey joke with him life. So therefore the only people wey fit enjoy sex during the World Cup na only players and fans wey don marry and dem come with dem wife or husband. But if you be single man or woman, e con get as waist take scratch you and you wan scratch am back, better try do soapie or samproma because if na to go find olosho or do hookup, na room and parlor dem go arrange for una inside their own Kirikiri there.

Qatar don first ban any LGBTQ things for World Cup so if dis guy go try dis thing for Qatar, na the next 21 years of him life e dey play with so

Upon on top of dat, if dem catch you dey kiss or smooch or romance for public, the type wey dem dey call PDA, whether na with your wife sef e no matter dis time, na jail you go land and nothing fit save you. According to the committee: “Qatar na conservative country so we no get time for ishekushe. And to dey play romance for public na haram for dis country, whether na man and woman, man and man, or woman and woman, make everybody just keep dem hand and other parts of dem body to demsef unless e go end in tears.”

”If na food una want, we go give una food na una go taya. If na games, if na normal flexing una go enjoy unasef. But una see dat gbenshing, make una die am. In fact e get as una go party too much, we go use police come arrest una. And of course una know say as a Muslim country we also ban alcohol so even una party sef, na Coke, Fanta and Malt una go drink there. Anything wey pass malt na haram wey go lead you straight to Kirikiri.”

My people e be like say Qatar people really serious for dis World Cup o. Dem don first ban all homo people say make dem no do mistake enter Qatar with dem behaviour or dem flag. Then dem warn England fans not to mistakenly carry mkpurummiri enter the country otherwise na 21 years in prison be dat. Now dem don kukuma ban anything sex or even public kissing and romancing. Very soon dem go say everybody must wear hijab.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version