As e dey Go

FIFA dey plan scrap throw-in from football and introduce kick-in instead

Published

on

We don dey hear now say FIFA don dey reason how dem fit take scrap throw-in comot from the rules of football kpatakpata and introduce kick-in to replace am instead. This mean say once ball cross line by the side, instead of to use hand take restart the ball with throw-in, na leg players go take restart am with kick-in.

Throw-in don become a major part of football since 19-kokoro. But na former Arsenal coachie, oga Arsene Wenger naim don dey whisper dis talk of replacing throw-in with kick-in inside FIFA ears since 2020. And since na him be the FIFA Chief Head of Global Football Development, part of him work na to see which rules dem suppose change to favour this beautiful game.

Why Wenger dey ginger for kick-in to replace throw-in

Arsene Wenger say na 3 major reasons make am dey ginger make dem migrate from throw-in to kick in. According to the former Arsenal boss: “throw-in dey cause ojoro well well because many players dey use am as excuse to waste time especially if dem dey win. So if the winning team get throw-in, you go see some players, even to bend down pick ball go be problem and dem fit spend like 10 seconds there. Others go begin jog ball wey dem suppose bend down carry jeje. Then some go dey move up and down for the line until ref go either show dem where to stand or dash dem card.”

Arsene Wenger, FIFA Chief Head of Global Football Development

Secondly, Wenger wan scrap throw-in because e no favour the team wey dey attack or the team wey dey lose because e dey make dem short 1. So imagine say your team dey hustle for equalizing or winning goal and you get throw-in. First of all, the player wey go throw the ball don already be short 1 because at dat point, him no dey the game. So therefore, throw-in no favour the attacking team but kick in go favour dem more.

Finally, Wenger argue say throw-in no even favour anybody wey get am but instead e dey favour the opponents. According to the man: “statistics don show say 8 times out of 10, the team wey get throw-in dey lose the ball especially inside dem own half. So if I win throw-in and e go favour my opponent pass me, e no better say I kuku leave am make the opponents do the throw-in make e for favour me instead? But if I get kick-in, da wan go make sense pass.”

My people FIFA dey reason to begin try dis new system of kick-in to replace throw-in anytime from now. The only thing wey we never understand na wetin go con be the difference between kick-in and free kick because with the eyes wey we take dey look am, apart from say na foul play dey cause one and not the other, the action wey dem go take restart the match na the same thing.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version