As e dey Go

Babalawos inside Peru don do crusade to help dem national team qualify for World Cup

Published

on

My people no be small something dey shele onto World Cup qualifying matter as we don dey hear now say some babalawo and ezemmuo inside Peru don dey do juju on top otumokpo even add ajelekeje on top to make sure say Peru national team win dem play off final to take qualify for Qatar World Cup.

Peru dey prepare to play the AFC-CONMEBOL Inter-Confederation Playoff Final against Australia on Monday and anybody wey win that match don enter Qatar. And according to this Peru ezemmuo dem, na the whole national association of babalawo inside Peru na dem dey run this ministry so.

According to the oga kpatakpata of the babalawo dem: “since dem go play the match on the 13th, we don arrange the 13 elders of the babalawos for the country wey also be the most powerful babalawo dem to run the prayer ministry. In fact, Peru qualifying for the World Cup na done deal because our people wey dey drink ogogoro take dey see vision don see our boys for Qatar. We also don see our people dey celebrate which mean say our qualification don sure.”

To run dem rituals, the babalawo and ezemmuo dem first carry the picture of dem own national team dey burn incense on top. After the incense dem pour some ogogoro on top, sing and dance around the picture before dem use some beautiful flowers and other fine fine things take decorate am.

After dem finish that one, dem carry picture of Australia national team, strong face on top, drop some heavy heavy swearing and curse on top, drop some animal blood on top, then each of the 13 elders of ezemmuo remove knife and cutlass begin chook the picture of the Australian national team players. After dem chook am finish, dem pour fuel on top, light matches take burn the picture to ashes.

Last time wey Peru and Australia jam na for the last 2018 World Cup inside Russia wey Peru beat dem 2-0.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version