As e dey Hot

Former Super Eagles skippo John Obi Mikel don finally retire from professional football at the age of 35

Published

on

Former Chelsea midfielder and Naija Super Eagles skippo, John Mikel Obi don finally retire from professional football. Mikel Obi dey dey 35 years and him career last 18 years.

The Nigerian midfielder start him career with Plateau United and na from there him play Naija U-17 before joining Lyn Oslo inside Norway league. After helping Nigeria win silver for the 2005 U-20 World Cup, everybody think say Mikel don sign for Manchester United only for am to turn up for Chelsea.

Na for Chelsea naim Mikel Obi make him name as the bobo spend 11 years for there, winning 2 Premier League, 2 FA Cup, 1 League Cup, 1 Community Shield and the oga kpatakpata of all of them, 1 Champions League title.

John Mikel Obi win UCL with Chelsea

Obi play 91 matches and score 6 goals on top for Super Eagles while also winning the 2013 African Cup of Nations with Super Eagles. Obi later captain the Naija National team and follow the Olympic team wey win bronze medal for the 2016 Olympics games inside Brazil.

Mikel career begin drop after leaving Chelsea as the bobo kuku carry himself go China go collect pension funds first with Tianjin TEDA before returning back to England to play for both Middlesbrough and Stoke City. From England the former skippo go join Kuwait SC where after playing 0 matches since 2021, the Naija legend don kuku decide to hang him boot.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version