As e dey Go

‘Any player wey no sabi sing national anthem no suppose play for Super Eagles’- NFF aspirant

Published

on

As the election for who go become the next Nigeria Football Federation (NFF) chairman don dey near, one of the contestants, oga Peterside Idah don come outside dey yan say, if una vote for am as NFF chairmo, one of the things wey him go do na to make sure say any Naija footballer wey no sabi sing national anthem no go smell Super Eagles.

Oga Peterside wey be former Super Eagles keeper open mouth yan diswan as part of him campaign strategy to take make sure say dis NFF chairmanship wey dey come so, emi lokan.

According to the man, when them dey sing national anthem before match, you go see some Super Eagles players as dem dey chop mouth because dem no sabi am. Oga Peterside yan say na wetin dey make many of those players not dey play well for Super Eagles be that.

If you check am, you go see say true true some players dey chop mouth when dem dey sing national anthem

According to the NFF chairmanship aspirant: I remember the first day wey I play match for Super Eagles. As national anthem start na so I jus dey sing am, dey shout am with water for my eyes. Na the kind passion wey I get to dey fit play for my country be that.

Oga Peterside say we no dey see that kind passion for the Super Eagles of today again because nowadays the players dey play for relevance and not because them dey proud and passionate about representing the country. And na this be the real reason why Super Eagles no dey do well again.

Idah Peterside say: go check the countries wey dey do well. Go check England whether you go see any player wey no sabi sing national anthem. Abi na France wey win World Cup? Go check Brazil the way dem dey sing national anthem like say na war. But for Naija we go dey sing our own like say we never chop since 7 days. Mbanunu.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version