As e dey Go

Super Eagles skippo Ahmed Musa share N100m to 5,000 petty traders for Jos

Published

on

My people diswan na very good news as we don dey hear say Super Eagles skippo, Ahmed Musa don share N100m to about 5,000 petty traders and small business owners inside Jos, the capital of Plateau state.

Una know say Ahmed Musa na proper Jos boy because na for Tin City there dem born am and na there him professional football career start with JUTH FC of Jos. And now, when many other players for carry dat N100m go Dorime and chop life inside club, Ahmed Musa wey dey 29 years old decide to use am take empower people inside dis harsh economy wey we dey do.

According to wetin we hear, each of the 5,000 traders collect 20,000 naira cash and na Musa use him own hand take share the money give each and every one of dem. But did no go be the first time wey Musa dey run dis kind charity parol. The bobo don build school, hospital, mosque and even training pitch to help improve people life.

Ahmed Musa na Naija top scorer for World Cup with 4 World Cup goals

And recently, when one picture of former Super Eagles player, Kingsley Obiekwu trend for social media as the bobo wey win 1996 Olympic good for Naija dey drive korope for Enugu, Ahmed Musa immediately wire 2 million enter the man akant make e take dey see front fes. Na all dis tin be the goodness wey Musa dey show wey make Nigerians dey love am the more even if him display for pitch no too sharp like before again.

But forget anything wey dey happen now, Ahmed Musa don already write him name for Naija football history of legends. Right from when him dey play Naija league, Musa break the record for highest goal ever for our league when him score 18 goals inside 25 for Kano Pillars inside the 2009/10 season. For national team, Musa na Naija best ever player for World Cup when become the first Super Eagles player to ever score 2 goals for 1 World Cup match. And him do am two times when e score twice against Argentina for 2014 before scoring twice against Iceland for 2018.

Musa also become the first Nigerian to score for 2 back to back World Cups as well as Naija top scorer for World Cup with 4 goals.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version