Connect with us

As e dey Go

Italian referee wey refuse to shake woman hand go chop 1 match ban

Published

on

Italian referee wey refuse to shake woman hand go chop 1 match ban

We don dey hear now say one Italian referee wey snob the handshake of him woman assistant, Juan Luca Sacchi, don dey warm up to collect one match ban from officiating. Diswan happen just before the Serie A match between Sassuolo and Lecce on Friday.

Although dem never make am official, the tory na say the oga kpatakpata of the Italian referee dem no like wetin happen at all so him don recommend punishment.

But the matter fit no be as people dey reason am. According to the tory, na before the match start as players don line up dey wait for officials to come lead dem out, as oga Sacchi reach there him first shake Sassuolo captain Gian Marco Ferrari hand.

Then as the ref turn to shake Lecce captain, Gabriel Strefezza, hand wey him see na him assistant, Madam Francesca Di Monte hand. The ref first shock before avoiding the woman hand to shake Lecce skippo instead. From there the ref lead the teams enter pitch.

Italian referee wey refuse to shake woman hand go chop 1 match ban

The snubbing pain the woman referee well well

While many people dey argue say as the Italian referee take shenk the woman hand no good and e look like misogyny, other people don dey defend the ref say the normal protocol at dat point na to shake the two skippo hand because the refs dem go don already welcome demsef when dem dey prepare for the match.

In other words, na the assistant ref, Madam Di Monte naim break protocol by bringing her hand and e no get anything to do weda she be woman or not. In fact the ref no even shake the other assistant hand wey dem for say him bone the woman shake the man so no case to answer there.

Anyway, we just dey wait to hear wetin the Italian Referee Association wey be AIA go talk on top the matter although we hear say the referee oga, Gianluca Rocchi dey para well well on top the matter.

Continue Reading
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

As e dey Go

Forget about the 3-0 flogging, Manchester United play very well – Erik ten Hag

Published

on

Erik ten Hag don tell Manchester United players say you either shape up or shape out

After collecting dat humiliating 3-0 flogging inside Old Trafford, Manchester United coachie, oga Erik ten Hag don come outside dey announce to the world say him boys play very well regardless of wetin the score line talk.

Ten Hag defensive formation look like e get comma because na both Harry Maguire and Johnny Evans start while Raphael Varane dey bench. Also the coachie start Victor Lindelof for left back when Regulion wey be natural left back dey bench.

VAR award City penarity after Rasmus Hojlund drag Rodri down inside 18 yard box. Erling Haaland use dat penarity take rediscover him Premier League scoring form to make am 1-0. Andre Onana make many excellent saves for dat match but him no fit deny Haaland second goal with one powerful header to make am 2-0.

Forget about the 3-0 flogging, my boys play very well - Erik ten Hag

Erling Haaland destroy Erik ten Hag boys

The third goal come after Onana make another excellent save to deny Rodri, only for the ball to come meet Haaland wey square the ball back for Phil Fodden to complete am 3-0. But Erik ten Hag don come outside dey defend him boys performance say dem play well. According to am:

If you watch the first half you go see am say nothing City take pass us. We jam dem head to head, if no be dat penarity maybe e for be first half draw. Even with the penarity sef, we too create chances wey we just no convert. See dat McTominay own, on a good day goal be dat ball. So yesterday na just bad day for market for us.

Manchester United don lose five out of 10 league matches so far dis season. Out of those five losses, three na for Old Trafford. And as e be now, dem dey 8th position on top table, eight points behind the Top 4 and 11 points behind Tottenham wey dey top league.

Continue Reading

As e dey Go

American footballer threaten to stab referee for street because of red card

Published

on

As e dey hot, we don dey hear say one footballer inside American League, Yohance Alexander don threaten to stab referee if him catch am for street. The reason for dis kind vawulence na because the ref nak Alexander red card during dem cup match wey shele inside New York.

Na during the 2024 US Open Cup Qualifying game between Alexander club, NY Renegades vs NY Pancyprians-Freedoms naim dis matter happen. According to the tory, NY Renegades dey collect 3-0 kponking when dem vex turn football to karate begin kick opponents leg instead of ball.

E no tay naim quarrel start and to settle the quarrel, ref begin distribute yellow card to the players of both teams wey involve for the fight. But somehow, Yohance Alexander no grading wetin dey happen na so e begin go dey argue with ref o.

Na dat argument make ref vex nak am red card but instead of to respect himself leave the pitch, Alexander continue to dey insult the ref until e vex tell the ref make e pray make him no catch am for street because if e catch am there, e go stab am anyhow.

American footballer threaten to stab referee for street because of red card

Some players just like to dey fight referee especially when dem collect red card

Na dat threaten make the referee provoke end the match after only 74 minutes and right now we dey hear say dem also don disqualify NY Renegades from the tournament because of the bad talk wey Yohance Alexander talk.

We also dey hear say Alexander fit collect one long ban from the league for dat threaten wey him threaten referee. On top of dat, both him and him club go chop huge fine so dat tomorrow if dem see referee, dem go respect am well well.

 

Continue Reading

As e dey Go

Sadio Mane don buy football club inside France

Published

on

Sadio Mane don buy professional football club inside France

We don dey hear now say Senegal striker, Sadio Mane don buy one football club inside France wey dem dey call Bourges Foot 18. The club dey play for the fourth division of French League.

According to the tory, e don tay wey Sadio Mane don dey find club wey him go buy but e no work out until now. And the former Liverpool winger no be stranger for Bourges Foot as him don dey donate money give the club right from time to help dem pay salary and buy players for more than 3 years.

Na all dis good-good things wey him dey do make am become paddy with the owner of the club as well as the mayor of the town wey the club locate. And as e be now, the club president don kuku advise am to close eyes buy the club so dat him go begin control the club fully.

Sadio Mane don buy football club inside France

Mane currently dey play for Al-Nassr inside Saudi

Bourges Foot 18 currently dey second to the last for Group B of French fourth division. But the club been dey perform better pass like dis, in fact the club don play for Ligue 2 before wey be the second division of French league. But since then things no go well with dem wey don push dem enter Division 4 so.

But as e be now, the club president and Mayor of the town believe say the way forward na to sell the club give Sadio Mane. And Mane sef wey start him football career for France, don tell dem say him plan na to reorganize the club and return am back to dem former glory.

Continue Reading

Trending