Connect with us

Wetin shele gan-gan

Ronaldo wan leave Manchester United for January because him don tire to be second choice

Published

on

Ronaldo wan leave Manchester United for January because him don tire to be second choice

After only 7 matches into the season, we don dey hear now say Manchester United striker and football legend, Cristiano Ronaldo don dey plan him movement unto how him go take escape from Manchester United when transfer market open for January.

According to wetin we dey hear, the reason why Ronaldo wan japa dis time no be even to hustle UCL football again but because for the first time inside him career, the GOAT don become second abi third choice striker for club and dat life on the bench no fit am at all.

Una remember say last transfer window Cristiano Ronaldo try all him best to getat from Manchester United because him wan play UCL and not the Europa wey United dey carry am go. After UCL clubs like Bayern Munich, Chelsea and even Atletico Madrid reject am, the bobo kuku decide to manage United.

Cristiano Ronaldo don finally find buyer and him don ask Manchester United to name dem price

Many clubs reject Cristiano Ronaldo including Atletico wey dem fans even do one big banner against the GOAT

But even the United wey him dey, things don change drastically for am. Apart from say him dey play Europa League for the first time, him no be first choice or even second choice striker again because Erik Ten Hag prefer to use either Marcus Rashford or Anthony Martial for striking.

In fact the coachie believe say Rashford fit score up to 20 EPL goals dis season. To make matters worse for Cristiano Ronaldo, some United players dey complain say him no understand Ten Hag tactics because him no follow them go preseason. So whenever Ronaldo dey match and the team dey try play to instruction, Ronaldo go dey vex say make them give am the ball.

On top of dat, Manchester United don lose the 2 matches wey Ronaldo don start for them; the last one against Real Sociedad for Europa League and the EPL match against Brentford wey dem chop 4-0 kponking.

So as e be so, e sure for everybody say Cristiano Ronaldo bench go long well well and na wetin wan make the bobo use day time take begin find black goat wey loss and him don begin think of him January movement from now.

As e dey Go

Wasted talent: Alan Shearer blast Marcus Rashford for wasting him career

Published

on

Transfer news: PSG wan sign Marcus Rashford, Manchester United don agree price with Rabiot

Premier League legend, Alan Shearer don come outside dey draw ear give Marcus Rashford take dey warn am say, if you no take time and begin behave yourself, you go waste this your talent and your career. This one na after Marcus Rashford miss Manchester United FA Cup 4-2 win against Newport on Sunday.

According to Manchester United manager, Erik Ten Hag, Rashford miss the match because him call in sick on the Friday before the match say him no go fit make am. But reports show say Rashford been go one night club on that Wednesday go over enjoy and na since after that club naim wetin dey do am begin do am. Ten Hag say na internal matter so him go deal with am internally.

But this one don make many people dey wonder say which kind internal issue go make player no even turn up on the day of match? Alan Shearer also recall sometime last season when the same Marcus Rashford chop punishment after him arrive late for meeting before one of them league matches.

Wasted talent: Alan Shearer blast Marcus Rashford for wasting him career

Alan Shearer

Na this one don make Shearer wey be Premier all-time top scorer de shake head with pity say Rashford just want to waste him talent. According to the legendary striker:

Marcus Rashford get big talent o, but the problem now be say him just want to waste am. Because we see the boy when him serious last season na. But this season so far, I no know wetin be him problem, whether him get family problem abi him girlfriend dey give am problem, or maybe na just village people, we need to help this boy and find out wetin be the problem otherwise him go just waste him career for nothing.

Alan Shearer also advice Rashford to find better manager and surround himself with wise people wey go dey remind am say if him continue like this and him career end, then him go truly regret him life and him wasted talent.

For now we dey wait to see how Erik Ten Hag wan take resolve Marcus Rashford internal problems.

Continue Reading

As e dey Go

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

Published

on

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

As AFCON 2023 don enter knockout stage wey them don pair Nigeria to play Cameroon for the Round of 16 so, Super Eagles legend, Segun Odegbami don come outside like KingKong dey beat him chest say this Cameroon match go too easy for Nigeria because we go beat them like small pikin.

This one dey come after the AFCON wey dey happen inside Ivory Coast progress from the group stage enter knockout stages. This talk confuse many people because even for the group stage self, the Super Eagles no really impress as them manage to score only three goals in their three matches still finish second for the group.

On top of that the ball wey them dey play no even dey sweet for eyes make we say na that one we take hold body self. But on top of all of this, Mathematical Segun believe say Nigeria wey no dey give fans joy go easily beat and eliminate five-time AFCON champions, Cameroon from the competition.

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

Segun Odegbami believe say Cameroon no be Nigeria mate

According to Odegbami:

Na this Cameroon wey everybody dey fear naim go be our easiest match for this AFCON. Because all those their gidigbo football wey them like to dey play no go work for this new stadium wey we dey go. The former stadium wey them been dey play rough like farmland. But na this smooth pitch naim we go catch them take show them correct pepper.

Segun Odegbami also talk say the Super Eagles dey improve for them game because after drawing their first match them win the last two. According to the legend, na progressive that so no shaking for that Round of 16 match.

Nigeria go play Cameroon for their Round of 16 match wey go happen on Saturday by 9pm Nigeria time. Wetin you think about that match? Abeg tell us for comment section.

Continue Reading

As e dey Go

No room for improvement for country wey don jabo from AFCON- Ghana fans

Published

on

No room for improvement for country wey don jabo from AFCON- Ghana fans

This 2023 African Cup of Nations (AFCON 2023) don dey tie wrapper. And after the Black Stars of Ghana squander 2-0 lead to finally draw Mozambique 2-2 take jabo from the competition, their fans don use provocation take dey attack them say them no try at all.

One fan wey them ask whether there is room for improvement for the team despite their poor showing, the fan tell them hoo-ha say no room for improvement for team wey them don eliminate.

Which kind room for improvement be that when we don eliminate from the competition? Na people wey qualify go dey find room for improvement, as far as Ghana is concerned, time for improvement don pass because the worst don already happen.

Na Jordan Ayew convert 2 penalties, one for each half to put Ghana up 2-0 and give them wetin oyibo dey call a seemingly unassailable lead. Na after 90 minutes naim unassailable lead become assailable when Geny Catamo convert Mozambique own penalty to make am 2-1 inside 91 minutes before Reinildo Mandava complete the comeback with 94th minute goal.

No room for improvement for country wey don jabo from AFCON- Ghana fans

Trezeguet and Mostafa help Egypt qualify

For the other match of the group, Mostafa Mohamed score 91st minute goal wey Egypt believe say them go take win 2-1 against Cape Verde only for Bryan Teixeira to score 99th minute equalizer for the Islanders to make am 2-2. But even the draw dey enough to qualify Egypt for the next round while Ghana carry their Ghana must go straight back to Kumasi.

Continue Reading

Trending