As e dey Go

Transfer news: Leicester don hammer £85m on top Fofana head, Balogun go leave Arsenal on loan

Published

on

We don dey hear now say Leicester city don hammer bride price of 85 million pounds on top the head of dem defender, Wesley Fofana. Dis money wey dem nak on top the guy head na to discourage any other club from coming to marry the player comot.

Una remember say Chelsea don dey chook eyes for Fofana body after Barcelona hijack Jules Kounde from dem. But with dis kind hooge money wey Leicester don put for the guy head so, dem don dey tell Chelsea say dem no ready to sell the player but if dem really serious to buy am then make dem ready to spend the kind money wey both Liverpool and Manchester United spend on top Van Dijk and Maguire.

Chelsea sef don kuku get the memo and dem don remove eyes from Fofana body begin look elsewhere, especially for Italy for dem defensive replacement. As e be now, dem don dey eye 2 Inter Milan defender wey be Denzel Dumfries and Milan Skriniar.

Folarin Balogun to leave Arsenal on loan

Naija blood, Folarin Balogun don agree to leave Arsenal on loan to join Reims inside French Ligue 1. The loan contract go last till next year. Balogun been dey complain say him no dey see playing time for Arsenal so hopefully him go play many matches for Reims.

Balogun get potential but somehow e no dey gel for Arsenal

Balogun na 21 years old striker wey don dey Arsenal all him career. While many people see am as one of the best young players for Arsenal academy then, him never really show say him get the morah to be the best for the main squad because whenever dem give am opportunity, him no dey fit take am.

Dis no go be the first time wey Balogun dey go on loan sha as the bobo spend last season on loan for Middlesbrough where him play 18 matches score 3 goals. Balogun don play age grade football for England although him fit play for Nigeria because him papa and mama from Naija. Him also fit play for USA because na there dem born am so him be citizen.

Manchester City don wash hand from Cucurella matter

Manchester City don finally decide to do like Pontius Pilate and wash dem hand comot from Marc Cucurella matter. According to the EPL champions, dem give up on the guy transfer because him club, Brighton and Hove Albion dey behave like amusu on top the guy matter.

Manchester City been dey toast Cucurella like sugar daddy dey toast slay queen but now dem don finally wash dem hand from the guy matter

E don tay wey City begin toast Cucurella to con replace Zinchenko wey dem plan to sell give Arsenal and the bobo don gree to join dem, even submit transfer request to Brighton. But instead of Brighton to give City igbankwu list and bride price wey dem go fit pay, dem nak 50 million pounds on top the guy head while City wan pay 40 million. And dis na exactly why we were where we wan wear where.

Chelsea wan hijack Frenkie De Jong from Manchester United

E be like say Chelsea never ready to give up on top Frenkie De Jong matter as we don dey hear say The Blues don ready to hijack the Netherlands player transfer from Barcelona. Manchester United don dey on top De Jong matter since 19kokoro but because of the ogbonge salary wey Barca dey owe am plus other commitments, De Jong no wan leave the club.

Chelsea wan hijack De Jong transfer from Manchester United

Chelsea been show interest one time before dem decide to face dem front small. But now e be like say Chelsea don finally decide say na De Jong be the way forward and dem don ready to do everything including selling Azpilicueta and Alonso to Barca to make sure say if the 25 years old boy decide to leave Barcelona dis transfer window, dem go redirect him movement straight to Stamford Bridge.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version