Wetin shele gan-gan

Barcelona no get money but dem spend pass Yahoo Boys- Bayern Munich coachie

Published

on

Bayern Munich coachie, oga Julian Nagelsmann don come outside dey complain say: Abeg make una come help me understand Barcelona because the kind miracle wey dey happen for dat club, e pass America wonder. Shebi Barcelona say dem no get money? So how come dem dey buy all the hot and expensive players wey dey for market?

Oga Nagelsmann yan say the way Barcelona dey spend money like yahoo boy dis transfer window, if na like so club wey don broke dey spend money, abeg him go like belong to dat kind club pass the one wey get money yet to spend am na problem.

Bayern Munich coachie oga Julian Nagelsmann dey wonder who dey bankroll Barcelona wey dem jus dey spend money like say dem do ogwu ego

Barcelona recently complete the signing of Robert Lewandowski from Bayern Munich on top 50 million euros contract. Before then dem don spend 75 million euros take buy Raphinha from Leeds and right now dem don ready to pay 60 million euros to take hijack Jules Kounde transfer from Chelsea hand.

On top of dat dem don manage to keep Dembele for the club as well as the improved package wey dem offer players like Franck Kessie and Andreas Christensen wey join on top free transfer. Barcelona still dey reason to bring Chelsea skippo, Cesar Azpilicueta and Marcos Alonso come and dem still dey target Ruben Neves from Wolves on top 50 million euros contract.

Na all diswan don make Bayern Munich coachie dey shake head say, mbanunu, unless Barcelona get pesin like Obi Cubana wey dey bankroll dem from side, dem no get any business to dey price players in the first place, talk less of to dey spend on top dem like say dem do blood money.

1 Comment

  1. Pingback: Yahoo-Yahoo: Neymar go appear for court to answer 419 transfer case

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version