Wetin shele gan-gan

Yahoo-Yahoo: Neymar go appear for court to answer 419 transfer case

Published

on

Omo no be small sontin dey shele for the life of Neymar as we don dey hear say the Brazil number 10 get case to answer inside Spain unto some wuruwuru and 419 behaviour wey occur during the time wey Barcelona sign am from him former Brazilian club, Santos.

Na the formula to share Neymar transfer fee dey cause gbege so. According to the tory, na 9 years ago when Barcelona sign Neymar from Santos, e get one investment company wey dem dey call DIS, dis company don invest in Neymar career sotay dem don entitle to 40% share of any transfer money wey anybody pay for Neymar head.

But when Barca sign Neymar for 2013, DIS no see dem 40% share which suppose to be about 20 million pounds based on the 49 million wey dem claim say naim be the transfer fee. Dem don dey call Barca and Santos plus even Neymar papa and mama make dem come settle the company dem share but nobody dey answer dem since 2013 till today.

Since 2013 wey Barcelona sign Neymar from Santos, DIS never see dem 40% of the transfer fee

Na diswan make DIS believe say Neymar and him people don run dem street turn dem to mugu wey dem take run yahoo-yahoo which is why dem don drag dem go Igbosere so. Now, both Neymar, him papa and mama, him coachie for Santos, oga Odilio Rodrigues and two former oga kpatakpata dem for Barcelona then, Sandro Rosell and Josep Maria Bartomeu, all of dem go join togeda go answer dis case from October 17 to 31.

E don tay wey Neymar transfer fee from Santos to Barcelona don dey cause wahala because at first dem been dey hide the real money wey dem pay for am. For 2013 when dem sign am, the 2 clubs first announce say na only 49 million pounds dem pay for am. But many years later naim the truth begin come outside say na actually 74 million and say Barcelona use fake contract take deceive people.

And now, even dis DIS wey hold dem for blokos so don kuku increase dem 40% from 20 million to about 30 million since e be say the real transfer fee don turn out to be 74 million pounds. And dem don swear say unless dem get dem money, nobody go leave dat court.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version