As e dey Hot

Our romance with Lionel Messi never end- Barcelona presido

Published

on

Barcelona presido, oga Joan Laporta don come outside with love for him face dey talk about Lionel Messi say: our romance with Lionel Messi never over o. Walai talai, our love nwantinti still remain and the GOAT chapter for Barcelona never close.

According to the Barcelona presido, the club go do everything possible to bring Messi back to end him career there so dat everything go maramma and both the player and the club go make sure say the story of dem romance end in a very sweet way wey go totori everybody.

Lionel Messi na the greatest player to ever play for the club, and many people dey argue say na him be the best player to ever play football. The GOAT join Barca when him dey just 13 years old and 3 years later when him dey just 16 years old, the bobo don play him first professional match for Barca first team.

Lionel Messi cry like small pikin when him finally leave Barcelona after 17 years of GOATness

From there the bobo no stop to look back as him just dey faya down without bus stop for the next 17 years. By the time him finish for Barca, the man don score 672 goals and win 7 Ballon d’Or, 10 La Liga, 4 Champions League and many many other trophies and awards.

Na all diswan make many people believe say na Messi be the GOAT of Barcelona but the way him take leave the club no be the way wey the biggest player for the club history suppose take leave and na da wan don make oga Laporte dey mushy-mushy on top the matter so.

According to Laporte, Lionel Messi na the greatest player to ever play for the club and the only other Barca legend wey near him level na Johan Cruyff. But na condition make crayfish bend which is why the club get to let the GOAT go after dem see say to keep am go run the club akant down.

But the presido still believe say one day na one day and Messi go return to Barcelona come end everything where e start.

 

You suppose like diswan: “Na only mumu dey talk say Ronaldo better pass Messi”- Marco Van Basten

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version