As e dey Go

Transfer news: Chelsea wan hijack Lewandowski, Barca don sign Raphinha

Published

on

For transfer news dis morning, e be like say dis transfer season na hijack season because immediately after we confirm say Barca don complete the hijacking of Raphinha from Chelsea wey hijack am from Arsenal, Chelsea don dey plan dem revenge which is to hijack Robert Lewandowski from Barcelona.

The Poland all-time top scorer don declare say him wan leave Bayern Munich. Na since then naim Barcelona don dey on top him matter sotay dem don price the bobo 2 times but Bayern Munich insist say if dem no ready to pay £42 million up front, make dem forget the matter.

Na diswan don make Chelsea jump enter the story now, and if dem manage sign the bobo, e go be big deal for dem. Lewandowski score 50 goals in all competitions for Bayern last season and any club wey sign am go sure say na bundle of goals naim dem buy put inside dem team.

Barcelona don finally sign Raphinha with €67m

Raphinha celebrating goal for Leeds

We don dey hear now say Barcelona don finally agree to sign Raphinha from Leeds on top total package of 67 million euros. Dis Raphinha transfer don get as e be because na Barca first get agreement with am before Arsenal con chook mouth before Chelsea carry dem sugar daddy behaviour enter the matter.

But as e be now, Raphinha don decide to stick to him first love and reject the toasting of other sugar daddies. Raphinha suppose complete him medical today before signing 5 years contract wey go make am a Barcelona player until 2027.

Sheyi Ojo don leave Liverpool after 11 years

Naija blood, Sheyi Ojo don finally join Cardiff after spending 11 years for Liverpool. The winger join Liverpool when him dey just 14 years and although him later play 13 times for dem, him no too see him period wey make dem begin send am on loan to clubs like Wigan, Wolves, Fulham, Reims, Rangers, Cardiff and Millwall.

Sheyi Ojo dey celebrate one of him goals for Cardiff

The 25 years old attacker impress for him last loan waka to Cardiff wey him score 5 goals a plus 7 assists inside 42 matches for dem. Na diswan make dem insist say dem must finally sign am. Other clubs like QPR sef dey find the bobo but aww be now, na for Wales naim him career go continue.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version