As e dey Go

Transfer news: Lisandro Martinez agree to join Manchester United, Koulibaly don sign for Chelsea

Published

on

For transfer news today, we don dey hear now say Ajax central defender, Lisandro Martinez don finally agree to join Manchester United on top 46 million pounds contract. According to the tory, the bobo don even pack all him bags and baggages to enter Manchester for him medicals.

E don tay wey United dey toast Lisandro Martinez. The bobo sef dey enjoy the toasting and to join United dey hungry am but Ajax no wan lose the player wey just win dem Player of the Season award after the club chop only 19 goals for full season.

But as e be now, Lisandro Martinez wey dey just 24 years old go finally join United on top 5 years contract. United wan rush the rest of the movement so dat Martinez go link up with him former Ajax coachie, oga Erik Ten Hag and so dat him go fit join the squad for dem preseason tour inside Australia.

Chelsea don sign Kalidou Koulibaly on top 4 years contract

Koulibaly don join Chelsea on top 4 years contract

Chelsea don complete the signing of Senegalese defender, Kalidou Koulibaly from Napoli on top 4 years contract with option to extend am with extra one year. Koulibaly wey Chelsea pay €40 million for don serve well well for Napoli and e don tay wey we dey expect say the bobo go don leave the club, especially when Manchester United dey pursue until dem use frustration go sign Harry Maguire instead.

Chelsea really need to strengthen dem central defence after dem allow both Antonio Rudiger and Andreas Christensen to waka leave the club on top free transfer. So the signing of Koulibaly wey be very experienced defender make sense even though some Chelsea fans dey wonder why dem dey nak defender wey dey 31 years 4 years contract.

Juventus wan sign Gabriel Magalhaes from Arsenal

Juventus wan collect Gabriel from Arsenal but e fit no work

Juventus don dey plan to sign Gabriel Magalhaes from Arsenal. The Brazilian central defender wey dey just 24 years old don play only 2 seasons for Arsenal and Juventus wan collect am to take replace Matthijs de Ligt wey don sure say him dey join Bayern Munich next season.

We no con know whether Arsenal go gree sell Gabriel because na one of dem best defenders be dat. Moreover dem no too get option for bench especially for dat central defence so to sell the ones wey dem dey manage go really hard well well.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version