As e dey Go

Messi fit play for Barca next season as Xavi don dey beg am to come back home

Published

on

We don dey hear now say Barcelona don start the process of bringing Lionel Messi back to the Camp Nou because their Vice President, oga Rafa Yuste don confirm say the Catalan giants don open negotiation to bring the World Best back to Camp Nou.

Messi leave Barca nearly 2 years ago after the club no fit afford to dey pay am again. And now, after playing 2 seasons for PSG, the seven-time Ballon d’Or winner look set to leave the Paris club after negotiations break down.

PSG say them no longer fit afford to pay Messi salary after Uefa nak dem fine of £8.6 million on top financial fair play matter. Another £56.3 million fine dey load if them no cut their cost and continue to dey spend money wey them no get like Yahoo Boys.

With Messi planning to leave, the matter now na which club go fit afford to pay am at least £740,000 a week wey him dey collect for PSG. Al-Hilal inside Saudi Arabia  don dey toast am to join them and compete against Cristiano Ronaldo there while Inter Miami inside US say them wan nak am the biggest contract in football history.

Lionel Messi cry like small pikin when him finally leave Barcelona after 17 years of GOATness

We no con know whether Barcelona get the kind money to fund Lionel Messi movement but the club look like them serious on top the matter. Sotay Barcelona coachie, oga Xavi wey be Messi former Barca teammate don even dey beg am to return back home:

”I know say the money matter na serious matter but the truth be say, Camp Nou na Lionel house and the man need to come back home. Messi na my paddy, I go happy if him dey my squad and I sure say the fans go love am too. Messi need to return for one last romance with us.”

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version