Wetin shele gan-gan

Uefa dey chook eyes for Arsenal, Barcelona and PSG matter unto financial fair play rules

Published

on

We don dey hear now say Uefa don dey chook eyes for the matter of about 20 clubs inside Europe unto say e be like say dem break financial fair play rules for 2021/2022. And when we torchlight the 20 clubs, we see am say na Arsenal, Barcelona and PSG dey top the table.

According to the tory, dis 3 clubs no dey make money but the way dem dey spend money, even Yahoo boys wey na free money dem dey spend no spend money anyhow reach dis clubs.

Arsenal splash money on top Gabriel Jesus even though dem dey run loss of about £213m

Take for instance Arsenal matter. For the last 3 years dem never make any single gain instead dem dey run on loss of about 213 million pounds inside the last 3 years. This is average of about 71 million every year. According to the financial fair play rules, the amount of loss wey dey acceptable for those 3 years join together na 25 million pounds.

That mean say even the money wey Arsenal dey lose per year pass the amount wey dem dey allowed to lose in 3 years. Yet dem still get money wey dem dey spend take sign players like Ben White, Aaron Ramsdale, Martin Odegaard, Gabriel Jesus and Zinchenko. How dem take dey manage do am naim Uefa don dey monitor so.

Barcelona no get money but dem spend pass Yahoo Boys

As for Barcelona, last year dem declare say dem no get money wey make dem finally release Lionel Messi to release funds for other players. Barcelona own worse sotay dem even dey owe players salary like some state government for Nigeria. Yet na dem dey hijack all the expensive players wey other clubs wey get money wan sign.

Barcelona hijack Raphinha with 55 million pounds. Dem hijack Kounde with 62.5 million euros. Dem collect Lewandowski with 50 million euros, dem sign Kessie and Christensen on top ogbonge contract, na small thing remain dem wan collect Bernardo Silva join. And dem still dey owe players salary.

We know say dem don sell all dem TV rights finish plus some other assets but even those ones sef na sign of club wey no balance well. So na how dem take dey do am naim financial fair play wan find out so.

PSG wey dey run loss of €348m still dash Mbappe 150m sign on bonus with new 3 years contract wey make am the highest paid player in the world and also give am mouth to decide which coach and which players to hire or fire

As for PSG, the new contract wey dem offer Kylian Mbappe alone don reach to open investigation for dem head because how club go nak player new contract, nak am sign-on bonus of about 150 million euros, still put am on weekly salary of 1 million euros per week? Dis na club wey make loss of 348.5 million euros in the last 2 years.

Na all dis blood money behaviour naim make Uefa dey shake head say dem must monitor dis clubs unto financial fair play rules matter so far dem go shalaye where dem from dey get all this money from.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version