As e dey Go

‘I don warn Messi, Mbappe and Neymar say none of dem big pass bench’- PSG coachie

Published

on

PSG coachie, oga Christophe Galtier don come outside dey warn him biggest players, Messi, Mbappe and Neymar say make them no think am too much because no matter as them big reach, none of them big pass to dey chop bench.

According to oga Galtier; I don kuku tell all of them. In fact I visit them one by one and I also tell all of them together as a team say nobody big pass bench. Whether your name na Lionel Messi or Kylian Mbappe, the day wey you go bench, you go bench because all of dem no go start every match. So I no want make anybody begin take am personal, say you dey bench no mean say you no sabi.

According to the coachie, the reason why him dey take dis step na because matches plenty wey the players go play and time no dey to play them. Sometimes na only 3 days them go get before dem next match because dis season no go long because of World Cup therefore them go rush many things.

Christophe Galtier don warn him players say nobody big pass bench

While this explanation make sense, the big players like Messi, Mbappe and Neymar go dey pray make the bench no too affect them like that. Because if you check the top scorers of the league so far, you go see am say na Mbappe and Neymar dey top with 7 goals each.

If you come check the assist ranking, na Messi and Neymar dey top with 6 assists each. Moreover, players like Neymar and Mbappe wey never win world best before go dey hustle for am this season and dem no dey compete for that award from bench therefore these players go always want to dey start match.

But then, fatigue no go help any of these players achieve greatness especially if the fatigue go lead to injury. And as World Cup go start next month, e make sense make everybody just take am easy instead of to dey form star boy.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version